Yoruba pipul
ethnic group
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokYoruba Langwej, English langwej, French, Brazilian Portuguese, Spanish Chenj-am
RilijonChristianity, Islam, Yoruba religion Chenj-am
KontriBenin, Naija, Togo, Gana, Canada Chenj-am
Language usedYoruba Langwej Chenj-am
Studied inYoruba studies Chenj-am

Yoruba pipul na one West Afrika grup of pipul dat stey in Naijá, Benin an Togo. Di nem of di aria wey Yoruba pipul dey stey na "Yorubaland".Di nomba of Yoruba pipul for Afrika pass 48 million. Outside Afrika, Yoruba pipul pass som hundred thousand.Na Naijá you fit see mejoriti of Yoruba pipul. In Naijá populashion, Yoruba pipul mek up to 21 paset akordin to CIA kalkulashion.Yoruba pipul dey amog one of di traib wey meni pass for Afrika.Na almost all yoruba pipul dey spik di Yoruba langwej. For Afrika, Yoruba pipul get bandiri wit Itsekiri to di Saut-East in di North-West of Niger Delta.Yoruba pipul get bandiri with Bariba to di North-West in Benin an Naijá.Dey also get bandiri wit Nupe to di North an get bandiri wit di Ebira to di North-East in sentral Naijá.For di east, Yoruba pipul get bandiri wit Edo, Esan an di Afemai grup in mid-westa Naijá.To di Southwest, Yoruba pupil get bandiri wit "Gbe" spikin pupil , Mahi, Gun, Fon, an Ewe who dey Benin an Togo.

Orijin of di wod yoruba chenj-am

Di fest time wey we wan see di wod yoruba for buk na one buk wey get di taitu "Mi'raj al-Ṣu'ūd" wey Ahmed Baba rait in di year 1614. As di wod yoruba dey di buk, e sho sey di wod dey popula sins 1500s. E neva rili klair di pesin wey fom an di minin of di wod Yoruba as meni pipul wet dey stodi pipul giv diffren rison to am. For ezampul:

  • Yarub (Son of Canaanite, Joktan) by Mohammed Bello
  • Goru ba by T.J Bowen
  • Yolla Ba.

For one buk wey Richard F.Burton rait about Yoruba in 1861.E tok na fom di wod Ori Obba dey tek fom di wod Yoruba. Ori Obba minin for yoruba langwej na Head King.Di wod Ori Obba don dey wey pipul don dey tok an rait am sins 1500s.

Big pipul wey bi Yoruba chenj-am