Lateef Adedimeji

Naija akto
Lateef Adedimeji
pesin
Industryfilm industry, cinema of Nigeria, entertainment industry Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Orijina nemAbdullateef Adedimeji Chenj-am
Fest nemLateef Chenj-am
Nik-nemCrying Machine Chenj-am
Wen dem bon am1 February 1986 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Pesin wey e mariAdebimpe Oyebade Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dufilm actor, film director, actor Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulOlabisi Onabanjo University, Bachelor of Science Chenj-am
Academic degreeBachelor of Arts Chenj-am
Wen e stat wok2007 Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Awod wey e koletCity People Entertainment Awards, Best of Nollywood Awards Chenj-am
Nominated forCity People Entertainment Awards, Best of Nollywood Awards, Africa Movie Academy Awards Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Adetola Abdulateef Adedimeji (dem bon am for February 1, 1986) na Naija akto an pesin wey dey produs fim. E kom popula wen e du im fest play for inside Yewande Adekoya muvi for 2013 wey bi "Kudi kelpto". E don akt for Naija muvi wey pas 100 sins wen e stat to dey akt for 15 years ago. Na im bi Brand ambassaador for Airtel an Numatville Megasiti.

Tori abaut im life chenj-am

Dem bon Lateef Adedimeji for 1st of February 1986 for Isolo,Legos Stet, southwest of Naijá.E kom from Abeokuta,for Ogun Stet.Im mama,Kudirat Adedimeji na pesin wey dey du smol smol bizness,an shi kom from Oyo Stet for Naija.

How e tek go skul chenj-am

Lateef go Ire Akari primari Skul, Isolo for Legos Stet. E kom go Ilamoye Grammar Skul for Okota, Legos.E go one trenin on top Studio Paformans for Onikan,Legos Stet.Na one organaizason wey no bi govament own (NGO) yuz one komuniti Life projet tek tren am to sabi how to rait an akt wel wel.E finish fom Olabisi Onabanjo univasiti, e kolet Bashelor digri on top Mass komunikeshon.

Im wok chenj-am

Lateef Adedimeji stat to dey akt for 2007 as pesin wey dey dans an kom enta onebskul wey dey tish pipu how to dans. Lateef Adedimeji na pesin wey dey rait tori for fim. Lateef Adedimeji don sho for plenti plenti stej plai sins di time wen e stat to dey akt for 2007 til e kom stat wok wit Orisun TV.E don dey akt sins wen e dey for Sekondri Skul.Leta, one NGO kom pik am sey mek e dey wok as dia informa an Kanselor for one HIV/AIDS kanpain.Lateef job na to yuz muvi wey e akt tek tish pipu Sex an Human rights mata.E fans (pipu wey like am wel wel) no sey e sabi akt plai wey dey tosh pesin hart an e sabi how to krai wel wel for inside muvi.

Wie dem gada di tori chenj-am