Adunni Ade
Industry | film industry |
---|---|
Man abi wuman | wuman |
Kontri wey e kom from | Naija, Amerika |
Nem for lokal langwej | Adunni Ade |
Orijina nem | Adunni Ade |
Fest nem | Adunni |
Famili nem | Adewale |
Wen dem bon am | 7 June 1976 |
Ples wey dem bon am | Queens |
Pesin wey e mari | unmarried mother |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | film actor, model, actor |
Pat of wok wey e put mind | theater arts |
Wie e go skul | University of Kentucky |
Academic degree | Bachelor of Accountancy |
Wen e stat wok | 2006 |
Rilijon | Christianity |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Notable work | Soólè, The Vendor, Diary of a Lagos Girl, Ratnik |
Awod wey e kolet | unknown value |
Personal pronoun | L484 |
Adunni Ade (dem bon am for June 7, 1982) na Amerika/Naija aktres an model.
How e stat life an skul wey e go
chenj-amNa for Queens, New York, United Stet dem tek bon Adunni Ade to German-Irish moda an Yoruba Naija fada. Adunni Ade bi Nollywood aktress and fashion model. E kom Naija wen e bi two years wit e perent to dey e grand fada beria.Adunni Ade grow for Legos Stet, Naija til e almost rish 20 years bifor e go bak to United State so dat e go fit go yunivasiti. Adunni Ade go Chrisland primary School.E go Bells Comprehensive Secondary School Ota, Ogun Stet for e sekondiri skul.Im papa wey bi Legos-bes , an soseful bizinessman na im go rid akounting. Adunni Ade get im digri for akounting for Univasiti of Kentucky for 2008. Bifor e kom bak to Naija, Adunni Ade Don wok wit di Stet of Kentucky for Housing sector wey dey gif living assistance an also State of Maryland Medical Insurance Department wey dey gif medikal insurance (Medicare and Medicaid) to pipul wey nid am.
How e tek wok
chenj-amAdunni Ade don wok for Housing and Insurance sectors for United States bifor e chenj to entatement indostrie.Adunni enta fashion modelling an sho for America's Next Top Model. Afta Adunni go bak to Naija, e fest Nollywood rol wey e akt na one yoruba langwej fim wey get di nem You or I for 2013.E pass 170,000 wey luk di smol vidio komedi skesh “Date Gone Bad” wey Adunni rilis for YouTube for 2014.Adunni don akt inside meni oda Nollywood fim both for Inglish an Yoruba langwej, inkludin som muzik vidio for Sound Sultan an Ice Prince.E risif Stella Awod fom di Nigerian Institute of Journalism for di wok e dey du to promot Nigerian Kolshor. For 2017, Adunni Ade bikom di brand ambassador for OUD Majestic. For 2018, Adunni rait an produs e fest yoruba fim: "Emi Mi - My Soul", na Saheed Balogun bi di dareto. Pipul wey dey di fim na Ibrahim Chatta, D'Marion Young, Sunkanmi Omobolanle, an Shola Kosoko . Leta dat year, e produs anoda Yoruba drama fim: "Ewa - Beauty", na Saheed Balogun bi di dareto an pipul wey akt inside di fim na Ibrahim Chatta, Yinka Quadri, Kunle Omisore, an Tayo Sobola. Adunni don akt insaid more dan 100 Fim for Naija (bot for Inglish an Yoruba pat of Nollywood).
E pasona life
chenj-amAdunni get two son D'Marion an Ayden. E opun up sey e go dey tek kia of di pikin dem afta di marej skata.