Babatunde Omidina
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejBabátúndé Omídínà Chenj-am
Fest nemBabatunde Chenj-am
Nik-nemBàba Sùwé Chenj-am
Wen dem bon am22 August 1958 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Island Chenj-am
Wen e kpai22 November 2021 Chenj-am
Place of deathIkorodu Chenj-am
Pesin wey e mariMonsurat Omidina Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor Chenj-am
Wen e stat wok1972 Chenj-am
Work period (end)2021 Chenj-am

Babatunde Omidina (22 August 1958 – 22 November 2021) na Naija akto an comedian wen e dey alive an pipul sabi am as Baba Suwe.

How e stat life chenj-am

Na August 22 1958 dem bon am for Inabere Street, Lagos Island wie im grow bot im orijin na Ikorodu local government area of Lagos State, southwestern Nigeria. Omidina du im pramari skul for Jamaitul Islamial Primary School for Lagos an Children Boarding School, Osogbo bifor e go Adekanbi Commercial High School for Mile 12, Lagos State bot e get West African School Certificate from Ifeoluwa Grammar School, Osogbo for Osun State, southwestern Nigeria.

How im work chenj-am

Omidina stat to dey du fim for 1971 but na pat wey him act for muvi wey di title na Omolasan wey Obalende produs, na e mek Omadina popula. E Kom popula wel wel afta e act for muvi wey bi “Iru Esin” wey Olaiya Igwe produs for 1997. E don act an produs plenti Naija muvi-dem like Baba Jaiye jaiye, wey Funke Akindele an Femi Adebayo act inside. For 2011, di National Drug Law Enforcement Agency tok sey im kari cocain wan travul komot. Bot afts dem kari di mata go court, di Lagos high court of law sey im no dey guilty, set evritin na lie lie. E lawer na di Bamidele Aturu, wey bi Naija lawyer and human rights activist.

List of fim wey e dey chenj-am

  • Ba o ku
  • Oju Oloju
  • Baba Londoner
  • Ko tan si be
  • Aso Ibora
  • Obelomo
  • "Elebolo"
  • Larinloodu

Im Death chenj-am

Babatunde Omidina (Baba Suwe) kpai for Monday 22nd of November 2021.

Wie dem gada di tori chenj-am