Joke Silva MFR na Naija aktress, daretor, an bizness wuman. Im 1998, Joke Silva dey inside one Oyinbo fim kol "The Secret Laughter of Women". Inside di fim, Colin Firth an Nia Long akt too. In 3016, Joke Silva win di Best Aktress in a Lidin Role for di 2nd Africa Movie Akademi Awod for di fim Women's Cot. In 2008, Joke Silva stil win Best Aktress in a Sopotin Role at di 4th Afrika Muvi Akademi Awod in di fim White Waters. Joke Silva pat na to do like Grama inside White Water.

Na Olu Jacobs bi Joke Silva hosband. Di hosband an wife get one kompini kol Lufodo Group. Di kompini dey produs an sel fim-dem. Dey stil get lLufodo Akademi of pafomin Akts as na Joke Silva bi di daretor of stodi for di Akademi. Joke Silva bi di M.D ( Maneji daretor) of Malete Film Village. Malete Film Village join bodi with Kwara Stet Yunivasiti to do tins. Naija govamet give Joke Silva one Awod kol Memba of di Orda of di Federal Riploblik on 29 September 2014.

How e tek start life chenj-am

Na for Legos, Naija dey bon Joke Silva inside di Saro/Amaro famili. Joke Silva papa nem na Emmanuel Afolabi Silva an e mama nem na Adebimbola Silva Joke Silva papa na lorya an e mama na doktor. E mama kpai in July 2015. Na 4 pikin Joke Silva peret bon. E great great gra-fada dem na Charles Phillips an Samuel Herbert Pearse.

How e tek go skul chenj-am

Joke Silva go Hili Child Kolej wey de Legos. E finish from Yunivasiti of Legos an e stil go Webber Douglas Akademi of Dramatic Akt wey de London. In di Eli 1990s, wen Joke Silva stil de Yunivasiti, na im e don dey akt fim. E join di kolshoral group wey Bode Osanyin an singa Stella Monye de. Joke Silva pak e stodi go one side for one year bikos e wan bi Aktress. Joke Silva peret no fest wan mek dia pikin bi Aktress but bikos of di fim bizness dey mek dia pikin happi, dey no get choice.

How e tek wok chenj-am