Adekunle Gold
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAdekunle Chenj-am
Famili nemGold Chenj-am
AliasAdekunle Gold, AG Baby Chenj-am
Wen dem bon am28 January 1987 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos State Chenj-am
Pesin wey e mariSimi Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga, pesin wey dey rait song, graphic designer Chenj-am
Wie e go skulLagos State University of Science and Technology Chenj-am
Wen e stat wok2010 Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Stai of song abi fimAfrican popular music, Afrobeat Chenj-am
Record labelYBNL Nation, Def Jam Recordings Chenj-am
Official websitehttp://wwww.adekunlegold.com Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Adekunle Almoruf Kosoko (dem bon am for January 28, 1987), wey pipul sabi as Adekunle Gold an AG Baby, na Naija Afrobeat singa an song raita. Pipul no am wel wen e rilis Sade song fo 2015, na hi-laif song. E du kontrat wit Olamide YBNL Adekunle Gold rilis e albom wey bi Gold for 2015, wey dey Nomba 7 for Billboard Wod albom shat. Bifor Gold albom, E don du 3 songs wey bi Sade, Orente an Pick Up. Adekunle Gold tel Naija Entertainment today sey, bifor im du kontrat wit YBNL, na im du disain for Olamide, Lil Kesh an Vitoh albom.

How e tek stat life chenj-am

Na for January 28, 1987 dey Tek bon Adekunle Almoruf Kosoko. Na fyo insaid Kosoko famili dem bon am.

Skul wey e go chenj-am

Adekunle Gold get Higher National Diploma (HND) for Arts an Desain fom Legos Stet Politeknik.

How e tek wok chenj-am

2010- 2014 Adekunle Gold karia Stat wen e dey smol.E tok sey na King Sunny Ade an Ebenezer Obey bi pésin wey endey luk up to.Adekunle dey for e chorch smol quaya wen e dey smol an e rait im fest song wen e dey 15 years old.For 2014, Adekunle komot for di grup wet e fom wen e dey skul kom stand alone. Meni pipul dey kol am King of Photoshop wen e du one foto wey e dey wit Tiwa Savage. For December 19, 2014, Adekunle rilis Sade an di song dey amog muzik wet fit win di Best Alternative Song for the Headies 2015.

2015- Present: Gold

Afta Adekunle rilis Sade, E kon rilis e fest sinu wey bi Orente an na for YBNL rekod e rilis di song afta e don du Kontrat wit dem on March 5, 2015. Adekunle nem dey for singa wey fit win beta singa wey get beta futsho for City People Entertainment award 2015. On July 18, 2016, Adekunle Gold mek pipul no di songs wey dey insaid im album wey bi Gold. Di albom get 16 trak, beta produsa wey wok for di albom na Pheelz, Mastercraft, B Banks, Slekaamo, Oscar an Seyikeyz. Na July 25 dem rilis di albom. Wen e rilis di albom, di albom dey nomba 7 for Billboard Wold Albom shart fyo di week 13 August 2016. Adekunle Gold komot for YBNL Nation wen e kontrat finish, E kon go du niu band wey bi The 79th Element. On January 15, 2018, Unity Bank pik Adekunle Gold as dia ambassador. Adekunle Gold rilis 'Afro pop vol. 1' albom on August 21, 2020. On February 4 2022, Adekunle Gold rilis e 4th albom wey bi "Catch Me if u Can", di Albom get 14 traks, an som oda singa wey sing insaid bi Davido, Fautoumata Diawara, Lucky Daye, Stefflon Don, Foushee, an TY Dolla $ign. Adekunle Gold wok wit difren produsa laik: Seyifunmi, Davayo, Rymez, Lekka, TMXO, Tay Iwar, Blaise Beatz, Kali, Que Beats, an Spax for di "Catch me if u Can".

E pasonal laif chenj-am

Adekunle mari Simi on January 2019 afta dey don dey date for 5 years. Dem bon baby in May 2020.

Adekunle tok sey di fest moto wey e get na Honda 1999 'Baby Boy' (Accord) an na fom e frend for Ghana e buy am. Adekunle kon tok sey di moto skata wen im frend kari am Kombat. Gold tok sey e sel di moto for 400,000 naira, afta e don du di moto.

Som pipul tok sey Adekunle dey mari Teminikan, wey dey du muzik vidio, for Simi bak. Di nius fest kom out for insaid Gistlover nius, wey sho pipul di gel foto, kon tel am sey mek shi run fo am. Gistlover kon stil sho pipul wey dey for Instagram foto wey komfam sey Simi sef no abaut am.

For July 15 2022, singa Adekunle Gold tel pipul sey e na sikla an sey na fom smol di disease don dey du am. Gold tok sey im du "5 star" song bikos of di sikla.

Muzik wey e don du chenj-am

Albom

.Gold (2016)

.About 30 (2018)

.Afro Pop Vol.1 (2020)

.Catch me if you Can (2022)

Som Of Im Singles

."Sade" (2014)

."Temptation" (2014)

."Orente (2015)

."Pick Up (2015)

."No forget me" feat Simi (2016)

."Ariwo Ko" (2016)

."Friend Zone" (2016)

."Nurse Alabere" (2016)

."Ready" (2016)

."My Life" (2016)

."Work" (2016)

."Beautiful Life" (2016)

."Fight For You" (2016)

."Sweet Me" (2016)

."Paradise" (2016)

."Call on me" (2017)

."Only Girl" ft Meologo (2017)

."Money" (2017)

."Ire" (2018)

.Damn Delilah (2018)

."Before You Wake Up" (2019)

."Young Love (2019)

."Kelegbe Megbe"

."Jore Feat Kizz Daniel (2020)

."Something Different" (2020)

."AG Baby" feat Nailah Blackman (2020)

."It Is What It Is" (2021)

."Sinner" (2021)

.High feat Davido (2021)

."Mercy" (2022)

."5 Star" (2022)

Awods and Norminations chenj-am

Awods An Norminations
Year Award Ceremony Prize Recipient/ Norminated Work Results
2015 Nigerian Music Awod Best New Art "Himself" Won
2016 Nigerian Entertainment Awod Best Song Pick Up Won
2016 The Headies Best Alternative Song "Sade" Won
2016 City People Entertainment Awods Album of di Year "Himself" Won
2017 City People Entertainment Awods Collabo of di Year "Himself an Simi" Won
2017 IARA Best African Music Artist "Himself" Won
2017 IARA Most Popular Artist "Himself Norminated
2021 Net Honours Most Played RnB Song "Pami" (DJ Tunez featuring Wizkid, Adekunle Gold & Omah Lay Norminated

Wie dem gada di tori chenj-am