Omah Lay
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Stanley |
Famili nem | Didia |
Alias | Omah Lay |
Wen dem bon am | 19 May 1997 |
Ples wey dem bon am | Port Harcourt |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Igbo langwej |
Wok wey e dey du | musician, singa, pesin wey dey rait song, producer |
Wie e go skul | University of Port Harcourt |
Wen e stat wok | 2019 |
Rilijon | Christianity |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Instrument | voice |
Stai of song abi fim | Afrobeat, Afrobeats, contemporary R&B |
Record label | Warner Music Group |
Hairstyle / hairlength | afro |
Personal pronoun | L485 |
Stanley Omah Didia (dem bon am for 19 May 1997), wey pipul sabi wel wel as Omah Lay, na Naija singa, song raita an Produsa. Pipul sabi am wel fo im song "Bad Influence" wey e du for year 2020. Meni pipul sabi am for di song wey Masterkraft du wit am an Alpha P, di song na remix for Justin Bieber 2021 "Peaches", anoda song wey som pipul sabi am wit na "Attention" wey dem rilis 2022. Na Omah Lay win di Next rated awod fo 2020 Headies Awods.
Hau e tek stat life
chenj-amDem bon Stanley Omah Didia on 19 May 1997 for inside Port Harcourt. Na fom Ikwerre Lokal Govment inside Rivers State. E go Comprehensive High Skul insaid Rivers State, E kon leta go University of Port Harcourt. E kom fom famili wey lik musik, im granpapa dey pley musik instruments fo singa Celestine Chukwu bifor e die fo 1977. Na Lay's Papa dey pley di drums.
Hau e tek du im wok
chenj-amLay stat im karier wit rap group, im nem na "Lil King" for di grup. E com leta dey writ song an dey produs musik. E rilis "Do not Disturb" in April 2019. E rilis "Hello Brother" afta one month wey e don rilis di first song.
E du kontrat wit KeyQaad rekod Label inside June 2019, bifor e kom rest for seven month. Wen e dey res, e dey wok on im EP, Get Layd. E tel OkayAfrika sey, Na sins August[of 2019] e don dey wok. E tok sey e no dey too uze im fone, no dey du wetin e dey du bifor so dat im go fes di projects wey e dey du wel. E tok sey di first song wey e rekod for di Layd project na 'Bad Influence'. Afta di rest, e rilis 'Bad Influence', wey dey inside song wey pipul see pas for Naijà Apple Music for inside 2020.
For February 2020, Lay rilis "You", wey bi im first single. E rilis im five trak EP, Get Layd on 22 May 2020. Di EP dey Nomba 1 for Naijà Apple Music Charts. Na all di five songs for di EP dey for top 15 fo Apple Music Chart for Naijà an na You dey fo nomba one.
For October, Lay dey for Olamide's album Carpe Diem, for di trak "Infinity", wey dey for top on Apple Music Chart fo Naijà.
On 20 November, Lay rilis im sekond five trak EP, What Have We Done. All di five trak EP riich di top 12 fo di Apple Musik Chart for Naijà, wit "Godly" wey dey nomba one.
For 3 July 2020, na Lay bi di first singa wey Apple kol to dey hep dem disease niu singa for Afrika. Inside December 2020, e dey fo BBC Radio 1Xtra's Hot 2021, na im bi di first Afrika singa for Audiomack's #Up Now wey dem du for niu singas. E dey fo Montreux Jazz festival's wey dey fo 20 singa pipul dey lik ci for 2021. Dem im win di BET's Amplified singa for di month of November 2020. Na Dvpper Music wey dey Naijà im sign for now, an kon stil sign fo Sire rekod fo im wok wey dey go outsaid Naijà. Im nem dey amog Singa wey fit win four Awods fo 2020 Headies, na im win di Next Rated Awod.
For June 25 2021, Lay dey folo sing for Naijà produsa Masterkraft song, "Peaches" remix of Justin Bieber. Na 8 July 2021, Lay rilis niu song, "Understand". On 3 March 2022, e rilis song wey e du wit Justin Bieber, "Attention", wey mek am bi di sekond song wey dem du togeda.
Diferen view
chenj-amOn 14 December 2020, dem aress Lay an Tems fo Uganda. Di Uganda polis tok sey dey no folo Covid-19 law fo dia kontri. Di singa no gree wit dem bicos dey tok sey na pesin arenj dia aress. Afta two days Uganda polis rilis dem, kon stil beg dem.
Politis view
chenj-amLay tok sey e dey sopot di #EndSARS campaign fo Naijà. E tel Harper's Bazaar, pipul sopos no sey di EndSARS na abaut Naijà pipul, no bi fo politis. Polis dey kill, beat pipul an dey du as dem lik. E stil tel dem sey mek Govment du somtin fo di mata.
Im wok
chenj-amStudio Albums
chenj-amTitle | Album details |
---|---|
Boy Alone | .Schedule Spring 2022
.Label: Sire, KeyQaad .Format: Digtal download, streaming |
Extended Play
chenj-amTitle | Extended Play details |
---|---|
Get Layd | Rilis: 22 May 2020
.Label:Sire, KeyQaad .Format: Digital download, streaming |
What Have We Done | Rilis: 20 November 2020
.Label: Sire, KeyQaad .Format: Digital download, streaming |
Singles
chenj-amAs lead artist
chenj-amTitle | Year | Album |
---|---|---|
"Do not disturb" | 2019 | Non album rilis |
"Bad Influence" | 2020 | Get Layd |
"Damnn" | 2020 | Get Layd |
"Forever" Remix (wit Gyakie) | 2021 | Non album rilis |
"Understand" | 2021 | Boy Alone |
"Free my mind" | 2021 | Boy Alone |
"Winter Wonderland / Don't Worry Be Happy" | 2021 | Non album single |
"Attention" (wit Justin Bieber) | 2022 | Boy Alone |
As Feature Artist
chenj-amTitle | Year | Album |
---|---|---|
Tonight (Spinal ft Omah Lay) | 2020 | Grace |
"Pami" (DJ Tunez featuring Wizkid, Adekunle Gold an Omah Lay) | 2020 | Non - album single |
"Pronto" (Ajeb Huslers featuring Omah Lay | 2021 | Kpos Lifestyle, Vol 1 |
"Peaches" (Masterkraft remix) | 2021 | Non album single |
Guest Appearances
chenj-amTitle | Year | Oda Artist | Album |
---|---|---|---|
"Infinity" | 2020 | Olamide | Carpe Diem |
"Abeg" | 2021 | Dj Neptune, Joeboy | Greatness 2.0 |
Produsa wey e wok wit
chenj-am2018
Kidoben Ace
."Caught up"
2019
Klug Ali
."Opium"
Skiboi
."One Day"
2020 Omah Lay - Get Layd
.2."Lo Lo" .4."Bad Influence"
Moveek
."Flossin"
Omah Lay- What Have We Done
.4."Confession"
2021
Jhay Jhay
."Welcum Party"
Awods an Normination
chenj-amYear | Awods | Katigori | Norminee/Wok | Results |
---|---|---|---|---|
2020 | Di Headies 2020|The Headies | Next Rated | Omah Lay | won |
Viewer's Choice | nominated | |||
Best R&B Single | "Bad Influence" | nominated | ||
Songwriter of the Year | Stanley Omah Didia – "Bad Influence" | nominated | ||
2021 | Ghana Music Awod | Best African Artiste of the Year | Omah Lay | TBA1 |
MTV Africa Music Awards | Best Breakthrough Act | pending | ||
Net Honours | Most Played Pop Song | ''Godly" | won | |
Most Played RnB Song | "Pami"
(DJ Tunez featuring Wizkid Adekunle Gold & Omah Lay) |
nominated | ||
All Africa Music Awards|All Africa Music Awards (AFRIMA) | Artiste of the Year in Africa | Omah Lay | nominated | |
Best Artiste in Western Africa | nominated | |||
Breakout Artiste of the Year | nominated | |||
Best Artiste, Duo or Group in African Pop | nominated | |||
2021 | Afro X Digitals Awods | Breakout Act of di year | Omah Lay | win |
Wia wi gada di tori fom
chenj-am- https://notjustok.com/article/interviews/meet-omah-lay-the-brazen-bad-boy-of-new-school-afrobeats/
- https://thenet.ng/fireboy-omah-lay-dj-neptune-and-more-make-impressive-win-debut-at-the-14th-headies/
- https://www.bbc.com/pidgin/tori-55313562
- https://www.bbc.com/pidgin/tori-55313562
- https://punchng.com/new-kids-on-the-block-omah-lay-laycon-bella-shmurda-and-other-artists-who-made-waves-in-2020/
- https://www.okayafrica.com/omah-lay-nigeria-interview
- https://www.pulse.ng/entertainment/music/here-are-the-top-10-nigerian-artists-of-2020/6b5nyfs
- https://www.top-charts.com/songs/all-genres/nigeria/apple-music/2020-W22
- https://www.top-charts.com/songs/all-genres/nigeria/apple-music/2020-W43
- https://www.top-charts.com/songs/all-genres/nigeria/apple-music/2020-W48