Enoch Adeboye
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Enoch Adejare Adeboye |
Orijina nem | Enoch Adejare Adeboye |
Fest nem | Enoch |
Famili nem | Adeboye |
Alias | Daddy GO, Pastor Adeboye |
Wen dem bon am | 2 March 1942 |
Ples wey dem bon am | Naija, Osun State, Q13140683 |
Pesin wey e mari | Foluke Adeboye |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Langwej wey e tek rait di wok | English langwej |
Wok wey e dey du | preacher, profeso, translator, author, pastor |
Wu e dey wok for | University of Lagos, Redeemed Christian Church of God |
Wie e go skul | University of Lagos, University of Nigeria, University of Lagos |
Wie e dey liv | Lagos, Redemption Camp |
Work location | Redemption Camp |
E pipul | Yoruba pipul, Yoruba Langwej |
Rilijon | Christianity |
Eye kolor | brown |
Official website | https://eaadeboye.com/, https://eaadeboye.com/contact/ |
Personal pronoun | L485 |
Enoch Adejare Adeboye (dem bon am for March 2, 1942) na Naija pasto an Jeneral ovasiya of Redeemed Christian Church of God.
How e tek stat life
chenj-amDem bon Enoch Adejare Adeboye on March 2, 1942 in Ifewara wey dey nia Ife in Souta Rijion in Naija.Enoch Adeboye famili no too get moni
How e tek go skull
chenj-amAdeboye in 1956 stat to go Ilesha Grama Skul wey dey Ilesha for Ogun Stet.Afta dat time, e fest go University of Nigeria, Nsukka (UNN) in Nsukka bot e no finish di skul bikos of di Naija sivu war.Adeboye kom go rid Matimatis an get e fest digri in 1967 for Univasiti of Ife. (di nem of di skul now na Obafemi Awolowo University). In 1967, Adeboye kom mari e wife, Foluke Adenike an dey bon four pikin:
- Adeolu Adeboye
- Bolu Adubi ( née Adeboye)
- Dare Adeboye
- Leke Adeboye
In 1967, Adeboye get Masta digri in Hydrodynamics fom Univasiti of Legos.In 1975, e get e Ph.D in Applied Mathematics fom di Univasiti of Legos.
E wok as pasto
chenj-amAdeboye join di Redemed Christian Church of God in 1973 an e du intapreta for di chorch bifor dey mek am pasto.Na pa Josiah Akindayomi in 1975.Adeboye kom bikom jeneral ovasiya of Redeem Chorch in 1981.For three years, Adeboye dey wok for University of Ilorin (Unilorin) an at di sem time, e dey du pasto. Afta three years wey e dey du tishin an prishin togeda, Adeboye stop to dey tish an yuz all e time an pawa faze prishin.Bifor Adeboye bikom di Jeneral ovasiya of Redeem Chorch, di Chorch no too popula like dat. Adeboye hep di chorch to dey kontri wey go rish 198 kontri an pipul wey dey go di chorch in Naija pass 14 million.Adeboye tok sey e plan na to mek sure sey mek pipul dey si di Chorch evri 5 minit wey dem don waka. Pipul tok sey Adeboye na pasto wey like to dey prish abaut moni an propati an e sef no folo dem chenj wod bikos of dat. Bikos Govament tok sey mek enibodi no yuz more dan 20 years tek du oga for organazashon wey no bi biznes Organazashon an sey mek enibodi wey don pass 70 years no bi oga, Adeboye risain as Jeneral ovasiya in 2017. Adeboye du e 80 years betday in 2022 an e giv hospitu plenti tins on dat day.
Buk wey e don rait
chenj-amAdeboye don rait meni buk, some of Dem na:
- Open Heavens Daily Devotional
- Lessons from the Sower
- Christian Moderator
- Deadly Enemy of Man
- Divine Favour
- Kingdom Prosperity
- Fruits of the Spirit
- God of Wonders
- God’s Remembrance and Deliverance
- Prevailing Prayers
- The Wonder Working God
- Transitions
- Mathematics & Greatness
Yunivasiti wey e don dash moni
chenj-amAdeboye don dash four Naija Yunivasiti tins.Di yunifasiti wey e don dash tins inklud: Obafemi Awolowo Yunivasiti an Yunifasiti of Nigeria
Awod wey e don risiv
chenj-amNewsweek (2008) tok sey Adeboye bi one of di fifti pupil wey get pawa for di hol wold. New Africa Magazine (2019) tok sey Adeboye dey among di 100 pipul wey get mouth pass for Afrika.
E pasonal life
chenj-amOn February 17, 1967, Adeboye mari Folu Adeboye. E don bon four pikin-dem (three boiz and one gel) and Adeboye get plenti gran-pikin.
On May 4, 2021, Adeboye pikin Dare Adeboye kpai at di age of 42 years.