Afe Babalola
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Emmanuel |
Wen dem bon am | 30 October 1929 |
Ples wey dem bon am | Ado Ekiti, Ekiti |
Relative | Bolanle Austen-Peters |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | lawyer, pedagogue, farmer |
Wu e dey wok for | University of Lagos |
Wie e go skul | London School of Economics and Political Science, University of London |
Honorific prefix | Order of the Niger, Order of the Federal Republic, Senior Advocate of Nigeria |
Wen e stat wok | 1963 |
E pipul | Yoruba pipul |
Eye kolor | black |
Notable work | Afe Babalola University |
Official website | http://www.afebabalola.com/ |
Afe Babalola (CON OFR SAN dey bon am 30 October 1929) na Naija lorya, an di fonda of Afe Babalola Yunivasiti.
How e life tek start
chenj-amNa for Ekiti Stet wey de Souta Naija dem bon Afe Babalola on 30 October 1929. Babalola rait im Sinior Kambrige Skul Satifiket Ezamineshon by pravet stodi from Wolsey Hall.
Babalola leta get anoda Satifiket wey bi A' levu Satifiket of London Yunivasiti bifor e enta London Skul of Ekonomik. For di skul, Babalola finish an kolet im Bachelor Digri in Ekonomik.
How e life tek start
chenj-amNa for Ekiti Stet wey de Souta Naija dem bon Afe Babalola on 30 October 1929. Babalola rait im Sinior Kambrige Skul Satifiket Ezamineshon by pravet stodi from Wolsey Hall.
Babalola leta get anoda Satifiket kol A' levu Satifiket of London Yunivasiti bifor e enta London Skul of Ekonomik. For di skul, Babalola finish an kolet im Bachelor Digri in Ekonomik.
How e tek work as lorya
chenj-amAfe Babalola fest start to dey do lorya for Ibadan. Ibadan na di kapita of Oyo Stet. Babalola work as one of di lorya wey dey setu wahala for kot onda Olu Ayoola an Co, law firm. Afta e don work for two years, Babalola go opun e own ofis in 1965. E kol am Afe Babalola and Co. (Emmanuel Chambers). For 1987, Babalola bikom SAN (Sinior Advokate of Nijiria). SAN na di hiyest posishon wey eni lorya fit rish for Nijiria.
Olusegun Obasanjo wey bi forma presidor of Naija, chuz Babalola as di pro-shanselor of Yunivasiti of Legos in 2001. Babalola de dis posishon till 2008. Wen e stil bi pro-shanselor, Babalola kolet two awod as di best pro-shanselor in 2005 an 2006. Babalola opun e own Yunivasiti in 2009. E kol am Afe Babalola Yunivasiti. Dey pik Afe Babalola Yunivasiti as di sekond best privet Yunivasiti an di nomba 17th out of 136 Yunivasiti in Naijiria. In 2002, Babalola enta as fellow in NICArb (Nigerian Institute of Chartered Arbitrators). Babalola bi di presidor of NICArb from 2017 go rish October 2021.
E pasonal life
chenj-amBabalola wife na Modupe Mercy Babalola. Di marej produs nine pikin. Two of Babalola pikin na Bolanle Austen-Peter an Folashade Alli (SAN)