Rotimi Akeredolu
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Oluwarotimi Odunayo Akeredolu |
Orijina nem | Oluwarotimi Odunayo Akeredolu |
Fest nem | Oluwarotimi |
Wen dem bon am | 21 July 1956 |
Ples wey dem bon am | Owo |
Wen e kpai | 27 December 2023 |
Place of death | Hanover |
Manner of death | natural causes |
Cause of death | leukemia, prostate cancer |
Pesin wey e mari | Betty Anyanwu-Akeredolu |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | lawyer, politician |
Post wey e dey | Governor of Ondo State |
Wie e go skul | Obafemi Awolowo University, Loyola College, Ibadan |
Party wey e dey for politis | All Progressives Congress, Action Congress of Nigeria |
E pipul | Yoruba pipul |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Replaces | Olusegun Mimiko |
Awod wey e kolet | Order of the Niger, Senior Advocate of Nigeria |
Official website | http://aketi.org |
Personal pronoun | L485 |
Olorunrotimi Oduntayo Akeredolu CON SAN (21 July 1956 - 27 December 2023) na Naija lorya an politishan wey sarf as govnor of Ondo Stet fom 24 February 2017 bifor e kpai on 27 December 2023.
Plenti pipu sabi am as "Arakunrin" , an di oda nem wey dem uze sabi am wel na "Aketi". Na bifor bifor Sinor Advocate of Nigeria (SAN) wey kom bi president of di Nigerian Bar Association in 2008.
On 21 July 2020, Na Akeredolu dem anous as di Ondo govnorship kandidate afta di primari eleshon onda di APC parti. Wen e bi govnor of Ondo Stet, na im bi di chairman of southwest Govnors forum, na forum wey hol govnors of southwest Nigerian Stets dey.
How dem bon am an skul
chenj-amDem bon Akeredolu on 21 July 1956 for owo to Revenvered J. Ola Akeredolu an Lady Evangelist Grace B. Akeredolu of Aderojiyu famili of Igbotu, Ese Odo, wey dey Ondo Stet.
Akeredolu stat im primari skul for Government Primary School, Owo. E kon stil go Aquinas College, Akure, Layole College wey dey Ibadan an Comprehensive High School Ayetoro, for im sekondri skul. E go University of Ife (nau na Obafemi Awolowo University) to go stodi lor an e finish in 1977. E kon go Nigerian law School in 1978.
How e tek wok
chenj-amAkeredolu na bifor bifor Attorney General of Ondo Stet fom 1997 to 1999. Insaid 1998, e kom bi Sinior Advocate of Nigeria. Na im bi bifor bifor chairman of di Legal Aid Council (2005 - 2006). In November 2009, e fes one kase of hau e du uze moni, dem leta no du di kase again.
Insaid 2012, di Nigerian Bar Association new dia niu secretariat wey dey Abuja, Akeredolu, di Nigeria Bar Association presidio kon tok sey na bikos taim don rish to sabi pipu wey don hep di association.
On 4 February 2022, Akeredolu nem dey insaid Grand Patron of di National Drug Law Enforcement Agency by dia chairman, retired Brigadier General Mohammed Buba Marwa.
How tek sik an kpai
chenj-amAkeredolu get Luekaemia wey dem dey tek kia for am sins January 2023, wey mek am no dey holways dey wok. Akeredolu kpai on 27 December 2023, na 67 years e dey Wen e kpai.
Nashonal honors
chenj-amIn October 2022, President Muhammadu Buhari giv Akeredolu Commander Of the Order of Niger (CON).
Wia dem gada tori
chenj-am1.Breaking Ondo declares Rotimi Akeredolu Governor Elect. Premium Times Newspaper, 28 November 2016.