Naijeria, Wi Hail Dee

Naijeria, Wi Hail Dee
national anthem
KontriNaija Chenj-am
Language of work or nameNigerian English Chenj-am
First lineNigeria we hail thee, our own dear native land, Chenj-am
Last lineAnd so with peace and plenty Nigeria may be blessed. Chenj-am

"Naijeria, Wi Hæil Dee" bi di foma nachonal antem of Naijeria, wey dey in yuz from independens for 1960 until 1978. Di present antem of Naijeria, "Arais, O Kompatriots," dey in yuz from 1978, and replaes "Naijeria, Wi Hail Dee."[1]

Histori chenj-am

"Naijeria, Wi Hail Dee" been dey in yuz as di fes nachonal antem for Oktoba 1, 1960.[2] Lilian Jean Wiliams, wey bi wan British expatriaet wey dey liv for Naijeria wen dem grant am independens bi di pesin wey kompoes di liriks of di antem.[2] Frances Berda kompoes di miuzik for "Naijeria, Wi Hail Dee."[2]

Di sekond nachonal antem, "Arais, O Kompatriots," replaes "Naijeria, Wi Hail Dee" for 1978.[2]

Liriks chenj-am

Naijeria wi hail dee

awa own dear netiv land

Though traibs and tong dey difa

In brodahud wi stand

Naijerians aul, dey praud to sav

Awa sovereign Modaland.

Awa flag ga bi a simbol

Say trut and justis reign

In peas or batul honour'd,

And dis wi kaunt as gain,

To hand on to awa pikin-dem

A bana witaut stain.

O God of aul kreashon

Grant dis awa wan request.

Hep us to biuld a neshon

Whe no man dey oppresd

And so wit peas and plenti

Naijeria fit dey blesd.

Kriticisim chenj-am

Wen "Naijeria, Wi Hail Dee" fes dey anaunsd, di niu nachonal antem fais kriticisim for a nomba of reasons. Di Deili Savis, wey bi newspaepa wey Yoruba oganaizashon Egbé Ọmọ Odùduwà dey prodius, start a rebelious kampaign against di nachonal antem, wey risolt to di fomaeshon of a komiti to kolet signaechos as a petishon.[3]

Referens chenj-am

  1. "Naijeria Nachonal Antem Komposa, Pa Ben Odiase, kpai". Gazele News. 2013-06-12. Archived from the original on 2017-09-27. Retrieved 2024-01-31.
  2. 2.0 2.1 2.2 2.3 "Gudnait, Pa Benedit Odiase (1934 – 2013)". National Mirror. 2013-06-30. Archived from the original on 2013-07-04. Retrieved 2024-01-31.{{cite news}}: CS1 maint: unfit URL (link)
  3. Mphahlele, Ezekiel (1960). "Naijeria on di Eve of Independens". Afrika Today. 7 (6): 4–6. JSTOR 4184128.