Mr Macaroni
Industry | entertainment industry |
---|---|
Man abi wuman | man |
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Debo |
Famili nem | Adebayo |
Wen dem bon am | 3 May 1992, 3 May 1993 |
Ples wey dem bon am | Lagos State |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | comedian, actor |
Pat of wok wey e put mind | theater arts, comedy |
Wie e go skul | Redeemer's University |
Wen e stat wok | 2012 |
Rilijon | Christianity |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Filmography | Survivors, Ayinla, Ponzi |
Awod wey e kolet | The Future Awards Africa Prize for Filmmaking, City People Entertainment Awards |
Nominated for | The Future Awards Africa Prize for Filmmaking, City People Entertainment Awards, Best of Nollywood Awards |
Official website | https://mrmacaronitv.com |
Personal pronoun | L485 |
Adebowale "Debo" Adebayo (dey bon am 3 May 1993) wey pipo no wel wel as Mr Macaroni na Naija aktor, pesin wey dey do smol smol fims wey de mek pipo laff an e dey kari pipo mata for head. Pipo start to dey no Mr Macaroni wen e start to dey do smol smol fim wey dey mek dem laff on soshal midiha. For dos vidio, e dey do like politishan an Suga daddi or like professor. Meni nems wey dey tek no Mr Macaroni for e fim na "Daddi wa" an "Professor Hard life". Pesin go no sey na Mr Macaroni dey tok wen di pesin hear "Freki Freki", "You are dorin wel" an "Ooin". Mr Macaroni dey yuz e fim tek fight for pipo wey no get pawa to helep diasef. In fat, Mr Macaroni see shege wen e join sopot di fight to komot how polis dey do enihow for di 2020 #ENDSARS.
How e tek start life an go skul
chenj-amNa for Ogudu, Legos Stet dey bon Mr Macaroni on 3 May 1993. Mr Makaroni famili get moni an na bot Kristen an Moslim dey inside e famili. Na for Ogun Stet e gra papa-dem kom from. Mr Makaroni gro up for Magodo aria wey de Legos.
Mr Makaroni go Tendecare Intanashibal Noseri an pamari skulwey de Ojota, Ogudu. But di skul now de for Magodo Isheri. Na Babcock Yunivasiri High Skul e go for e sekondiri skul edukeshon. In 2009, Mr Makaroni enta Lead Yunivasiti to go rid law but e komot for year 2 bikos of sey Naija govment no gree mek Lead Yunivasiti dey tish law. By di time wey 2011 wan kom, Mr Macaroni don de Houdegbe North American Yunivasiti, wey de Cotonou in Riploblik of Benin dey rid law. Bikos of sey e dey like dey tok an e no like shitin for skul, di skul tel am mek e dey go an e no kom finish to kolet e satifiket for di Yunivasiti.
Mr Makaroni kom tok for e mind sey e no go skul again, but e go dey do fims. E kom akt inside some komedi fims for somtimes. Sins Mr Makaroni peret wan mek e shaa go skul, e kom chuz to go rid Tihata Akt (Theatre Act) fpr Afe Babalola Yunivasiti wey de Ado-Ekiti for Ekiti Stet. Mr Macaroni no stil finish e stodi for Afe Babalola Yunivasiti bikos of one tin one tin like dat.
Mr Makaroni in 2013 enta Redeemer's University Nigeria wey de Ogun Stet an na for dis Yunivasiti e kom finali finish an kolet e digree satifiket in Tihata Akt an Fim Stodis in 2018.
How e tek wok
chenj-amMr Makaroni fest start to dey akt for Nollywood bifor e enta mekin smol smol komedi vidio. Mr Macaroni tok sey na bikos of sey pipo no kol am for fim mek am start to dey do komedi vidio by imsef E tok sey for e komedi vidio, e like to dey fo like Suga Daddi bikos plenti Suga Daddi plenti for our aria wey no fit kontro diasef.
Mr Makaroni tok sey e no sey e go sabi komedi bikos wen e dey kopi how pasto Chris Oyakhilome dey tok, meni pipo dey laff wel wel.
For e smol smol komedi vidio, Mr Makaroni dey yuz popula aktor an aktress. Som of di popula aktress an aktor bi: Jim Iyke, Bimbo Ademoye, Lateef Adedimeji, Sola Sobowale, Falz an Mr.P. Mr Makaroni don also yuz of e fonni memba wey dey do komedi vidio like am. E don yuz Mr Funny (Oga Sabinus), KieKie, Remote, an Broda Shaggi. Ooni of Ife Adeyeye Enitan Ogunwusi don de Mr Makaroni smol smol komedi vidio tu.
Fims-dem wey e don do
chenj-amYear | Tahitu | wetin e do | Notes | Ref |
---|---|---|---|---|
2021 | Ponzi | Uchenna | ||
Ayinla | Bayowa | |||
2022 | Survivors (2022 film) | |||
Aníkúlápó (film) | Akanji | |||
King of Thieves: Agesinkole | ||||
Brotherhood | ||||
2023 | Gangs of Lagos | |||
Jagun Jagun |
TV show
chenj-amTahitu | Wetin e do | References |
---|---|---|
Okirika | Alaga | |
Ile Alayo | Sweet Daddy | |
Flatmates | AK 47 | |
The Johnsons | Casper |
EndSARS
chenj-amMr Makaroni don rili join di End SARS kampain. On Saturday, 13 February 2021, Polis harest am for Lekki Roll Gate dorin di #OccupyLekkiTollgate protest.
On February 2021, Polis harest an not Mr Makaroni an plenti oda pipo wey dey protest
Awod-dem an Nomineshon
chenj-amYear | Awod | karigori | Risot | Reference |
---|---|---|---|---|
2018 | Best of Nollywood Awards | Revelation of the Year – male | Nominated | |
2020 | The Future Awards Africa | Content Creation | Won | |
City People Music Award | Comedy Act of the Year | Won | ||
2021 | Net Honours | Most Popular Comedian | Nominated | |
2022 | Africa Magic Viewers' Choice Awards | Best Online Social Content Creator | Nominated | |
2021 | Gage Awards | Online Comedian of the Year | Won |