Michael Sani Amanesi (dem bon am for August 14, 1992) wey pipu no wel wel as MC Lively na Naijá komedian an akto fom Agenebode, Edo Stet Naijá.

Tori of e laif an skul wey e go chenj-am

Na Ogun Stet de tek bon MC Lively.E go Ideal Nursery and Primary School an Moremi Hi Skull. Afta e finish Sekondiri Skul, MC Lively go Obafemi Awolowo Univasiti wey e tek rid Law. MC Lively bikom Barista for 1996, bot e laik Komendi pass di Barista.

How e tek stat komendi wok chenj-am

MC Lively stat to dey du Komendi for 2015 an na di smol smol fonni Vidio kol Agidi mek am popula for Naijá. Agidi na smol smol Vidio wey e du wey dey tok abaut haad laif for Naijá. MC Lively don do sho wit popula komedia like Akpororo I go dai. MC Lively akt insaid the fim Seven and Half Date (2018). For di fim, e akt di pat of James, Bisola sekond boifiend. MC Lively akt as Dele in Fate of Alakada, di Komendi fim wey komot for 2020.