Akpororo
Industry | film industry, entertainment industry, cinema of Nigeria |
---|---|
Man abi wuman | man |
Kontri wey e kom from | Naija |
Wen dem bon am | 3 October 1989 |
Ples wey dem bon am | Waffi |
Pesin wey e mari | unknown value |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | actor |
Pat of wok wey e put mind | theater arts |
Wie e go skul | Lagos State University |
Academic degree | Bachelor of Arts |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Notable work | The Antique |
Awod wey e kolet | 2015 Golden Icons Academy Movie Awards |
Nominated for | 2015 Golden Icons Academy Movie Awards, 2014 Nigeria Entertainment Awards, 2016 Africa Magic Viewers Choice Awards, 2016 Nigeria Entertainment Awards |
Endorsed by | Airtel Africa |
Personal pronoun | L485 |
Bowoto Jephthah Oluwatiseyifunmi Tanimola wey pipo no wel wel as Akpororo na Naija komendian, singa an aktor
How e tek start life
chenj-amAkpororo na "Ilaje" pesin wey kom from Ondo Stet. Na for Warri wey de Delta Stet Akpororo tek gro up an na Delta e tek go skul. Akpororo dey rid Soshiorloji. Akpororo na 5ft, 7 inches
How e tek wok
chenj-am- 2008
Akpororo fest dey sing Kristen song for lokal aria onti 2008 wen e tek pat in Nashonal Komedi Shalenj. Na Opa Willias get di sho. Akpororo kari fest for di pat wey dem do for Kalabar.
- 2009
Akpororo kom to Legos in 2009 an e join for AY Opun Mic Shalenj. Di two time wey Akpororo pafom for di sho, e kari sekod an di next one wey folo, e kari fest.
- 2013
Akpororo pafom for "Basketmouth Laff an Jam" sho.
Na dis sho mek pipo sabi Akpororo wel wel. Akpororo kom start to dey pafom inside meni Komedi sho like AY Live
- 2014
For 12 August 2014, Akpororo do e fest Komedi sho wey e kol "Akpororo vs Akpororo" inside Muson Sentral. In di sem 2014, Akpororo start to dey Akt fim an e Akt inside "Headgone", an anoda fim The Antique. Di way Akpororo tek Akt inside "Headgone mek dem nominee am three time at di 2015 Goldin Icons Akademi Awod.
How e dey tok e jokes
chenj-amAkpororo like to dey tok funny tins wey dey happun for chorch. E tok sey na bikos e don bifor bi pesin wey dey kontro menta pipo group wey kom chorch.
Kompini wey e don helep sell dia prodot
chenj-amFor June 2015, Akpororo sahin 2 year pepa with fone line kompini Airtel Naija.
Awod-dem
chenj-amYear | Awod serimoni | Prize | Resolt | Ref |
---|---|---|---|---|
2016 | 2016 Nigeria Entertainment Awards | Best Comedy Act | Nominated | |
2016 Africa Magic Viewers Choice Awards | Best Actor in a Komendi | Nominated | ||
2015 | 2015 Nigeria Entertainment Awards | Komedi Act of the Year | Nominated | |
2015 Golden Icons Academy Movie Awards | Best Komendi Act | Won | ||
Best New Aktor | Nominated | |||
Best Komendi Akt (View's Choice) | Nominated | |||
2014 | 2014 Nigeria Entertainment Awards | Komendi Akt of the Year | Nominated | |
2014 BEN Television Awards | Comedian of the Year | Nominated | ||
2014 Naija FM Comedy Awards | Best Comedian of the Year | Won |
E pasonal life
chenj-amAkpororo Mari Josephine Ijeoma Abraham on 14 November 2015. Di marej happun in Surulere, Legos Stet