Joe Ajaero
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am1964 Chenj-am

Joe Ajaero (dem bon am 17 December 1964) na Naija jornalis, pesin wey dey put mouth for bizness mata, an e dey fight for wokas to get wetin dem nid.

Na Joe Ajaero bi di niu Naija Lebor Congress. E tek-ova from forma lebor lida Ayuba Wabba. Ayuba Wabba bi di lida of Naija Lebor Congress from 2015 go rish 2023.

How e tek start life an go skul

chenj-am

Na for Emekuku, wey de Owerri in Imo Stet dem bon Joe Ajaero on 17 December 1964. Joe Ajaero go Yunivasiti of Nigeria go rid Edukeshon. Di Yunivasiti give am e B.Sc satifiket in 1990. In 1994, Joe Ajaero get im Diploma in Jornalis from Times Journalism Institute. Joe Ajaero go do e Masta Digree in Indostrie an Lebor Rileshon from Yunivasiti of Legos. E finish e Masta Digree in 1998. Joe Ajaero stil go rid Law in Baze Yunivasiti. E finish an kolet e B.Sc satifet from Baze Yunivasiti in 2023.