Iyabo Obasanjo
pesin
Part ofNigerian senators of the 6th National Assembly Chenj-am
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am27 April 1967 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
StepparentStella Obasanjo Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duepidemiologist, politician Chenj-am
Post wey e deymember of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulCornell University, University of California, Davis, University of Ibadan Chenj-am
Academic degreedoctorate, Master of Science, Bachelor of Science Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am

Iyabo Obasanjo (dem bon am for 27 April 1967) na bifor bifor Naija Seneto an gel pikin of Naija forma Presidor Olusegun Obasanjo wey e wife Oluremi Obasanjo bon for am.

Tori abaut e life an skul wey e go chenj-am

Iyabo go skul for Corona School wey dey Victoria Island, Lagos, Capital School for Kaduna, an Queen's College for Lagos. E get digri for Veterinary Medicine from di University of Ibadan for 1988. Iyabo get master digri for Epidemiology fom University of California, Davis in Davis, California, United States, for 1990, an PhD from Cornell University for Ithaca, New York, for 1994.

How e tek du Politis chenj-am

Bifo Iyabo bikom Senato for Naijá, e bi Ogun State Commissioner for Health. Iyabo win eleshon for April 2007 mek e bikom Naija Seneto wey dey reprisent Ogun Sentral Senatorial District of Ogun State. For Aril 2011, e lost eleshon wen e wan bikom Seneto again. Na Olugbenga Onaolapo Obadara win am for di eleshon.

E pasona life chenj-am

Iyabo Obasanjo mari Oluwafolajimi Akeem Bello for September 1999. Di marej skata afta Iyabo kari e hosband go kot for 2003. Iyabo bon one pikin for am. Na boi pikin an e nem na Jimi Bello wey e bon for January 1, 2000 for Chatham County, North Carolina, USA.

Wie dem gada di tori chenj-am