Hilda Effiong Bassey (dem bon am September 20, 1996) wey pipo sabi as Hilda Baci na Naija wuman wey sabi mek fud for pipul to chop an e stil dey akt fims.Hilda Baci bi di fest pesin wey wan mek fud in di kishin for straight 100 hours. Na Hilda win di "Jollof Faceoff " kompetishon wey dey du for August 2021.

How e tek stat life an wok chenj-am

Na for Nsit Ubium Lokal Govamet wey de Akwa Ibom Stet in Naija dey tek bon Hilda on September 20, 1966. E rid Soshioloji from Madonna Yunivasiti wey de Okija. Hilda get B.Sc in soshioloji. Hilda bi di prisenta of di TV show "Dine on a Budget" wey Pop Central TV, DSTV Channel 189.

Fims-dem wey e don du chenj-am

Year fim nem pat we e du
2020 Dreamchaser
2021 A Walk on Water Annie
2023 Mr & Mrs Robert Hilda

Guinness Wold Rekod tori chenj-am

For March 2023, Hilda tok sey e wan bi di fest pesin wey go yuz plenti time for kishen to dey mek fud for pipo. If Hilda fit du am e nem go enta one buk wey di nem na Guinness Wold Rekod. Di pesin wey get di rekod for di buk wey Hilda wan tek ova d rekod na Lata Tondon. Lata Tondon enta di rekod buk in 2019. For May 11, 2023, Hilda stat to dey mek fud to break di rekod an e nem di hativiti Cook-a-thon. E break di rekod on May 15, 2023. By di time wey Monday May 15, 2023 araund 7:45 am, r don cook or mek fud for 87 hours 50 miniti an dis one mek am yuz 5 miniti pass Lata Tondon as di onli pesin for rekod to mek fud for that time. Na 96 hours Hilda get for mind to stop, but e kom stop to mek fud afta 100 hours wey e stat.

Wen Hilda stat to mek di fud-dem, meni big big pipo kom sopot an give am mora so dat e no go taya. Some of dem na: Govno of Legos Stet, Babajide Sanwo-Olu; Pastor of Harvester International , Bolaji Idowu; Naija singa-dem Tiwa Savage, Tim Godfrey, Ice Prince. Di Vais-Presido of Naija, Yemi Osinbajo imsef kom to give Hilda mora for di cookin. Meni Naija pipo rili sopot Hilda an e nem jos de meni sosha midiha wen di cookin stat.