Babajide Sanwo-Olu

He be Niger Politician /Lagos State Governor
Babajide Sanwo-Olu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejBabajide Olusola Sanwo-Olu Chenj-am
Orijina nemBabajide Olusola Sanwo-Olu Chenj-am
Fest nemBabajide Chenj-am
Famili nemSanwo, Olu Chenj-am
Wen dem bon am25 June 1965 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Pesin wey e mariIbijoke Sanwo-Olu Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyLagos State Governor Chenj-am
Wie e go skulLondon Business School, John F. Kennedy School of Government, University of Lagos Chenj-am
Academic degreeMaster of Business Administration Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Babajide Olusola Sanwo-Olu (dem bon am for June 25, 1965) na Naija politishian an di korent Gofnor of Legos Stet. E bikom gofnor onda di All Progressives Congress (APC) pati. Wen e kontest for who go be gofnor primaries onda di All Progressives Congress egeinst di rulin Gofnor Akinwunmi Ambode of Legos Stet for October 2019, e no expet sey e go win. Sanwo-Olu finish from Univasiti of Legos, London Business School, Legos Bizinez Skul an di John F. Kennedy Skul of Govament. Bifor im kontest as gofnor, Sanwo-Olu bi manejin daretor an CEO of Legos Stet Propati Divelopment Corporation (LSPDC).

Skul dem wey e go chenj-am

Sanwo-Olu get BSc for Surveying an MBA fom di Univasiti of Legos. Im bi alumnus of John F. Kennedy Skul of Govament, di London Bizinez Skul an di Legos Bizinez Skul.

E bi associate memba for Chartered Institute of Pasona Manejment (CIPM) an fellow of di Nigeria Institute of Training an Divelopment (NITAD).

Im wok chenj-am

How e tek wok for bank chenj-am

Babajide Olusola Sanwo-Olu don bi treasura for foma Lead Merchant Bank fom 1994 to rish 1997.E kom muv to di United Bank for Africa as hed of Foreign Money Market. E stil muv to First Inland Bank, Plc (now First City Monument Bank) as deputi jeneral manija an divishional hed. E don be shairman of Baywatch Group Limited an First Class Group Limited.

How e tek wok for govament chenj-am

Babajide Olusola Sanwo-Olu stat im politikal wok for 2003, wen e bi Speshial Advaisa for Koporet Matta for di den deputi govnor of Legos Stet, Femi Pedro. Dem kom mek am aktin kommissiona for Ekonomik Planning an Budget ontil 2007.Afta dem mek am kommissiona for commerce an Indostri by den Gofnor, Bola Tinubu. Afta di General Elekshon for 2007, dem chuz Sanwo-Olu as Kommissiona for Establishments, Training and Pensions. For 2016, Gofnor Akinwunmi Ambode mek Sanwo-Olu Manigin Daretor/CEO of di Legos Stet Divelopment an Propati korporation (LSDPC). Som tins wey e du as poplik savant na di supavishun of di Bureau of Public Enterprises (BPE) privatization projects. E still set up an bi di Board shairman of Legos Sekuriti Trost Fond. Na Sanwo-Olu set up di LAGBUS Sistem an di kontrol & kommand senta for Alausa Ikeja.

Politis mata chenj-am

For September 2018, Babajide Olusola Sanwo-Olu tok sey e go kontest for gofnor of Legos Stet onda di platform of di All Progressives Congress (APC) egenst di inkumbent govnor Akinwunmi Ambode. As e tok sey e go kontest, e get sopot fom pipul wey get mouth for Legos Stet politiks; inkludin di Gofnor’s Advisory Council of di Legos shapta of di All Progressives Congress and membas of di Legos Stet House of Assembly. Na dis wan mek Dr. Femi Hamzat, wey e sef wan bikom Gofnor bifor for di platform of All Progressives Congress drop sey e no ron as govnor egen. E win di Legos primaries eleshon for kandidat wey wan bi Gofnor for di All Progressives Congress (APC) for October 2, 2018. Wen APC stat to kampan for January 8, 2019, di Govnor of Legos, Akinwunmi Ambode, an 63 politikal parti sopot Mr Babajide Sanwo-Olu. Sanwo-Olu yuz beta gap win im oponet, Jimi Agbaje for di 2019 Legos Stet jeneral eleshon. Dem chuz Sanwo-Olu as Gofnor of Legos Stet for 2019 jeneral eleshon for Legos Stet for March 9, 2019. For May 29 2019, Sanwo-Olu tek oath to bikom di 15th Gofnor of Legos Stet for Tafawa Balewa Square (TBS) Legos Island.

Sanwo-Olu don du difren divelopment wok like road konstroshion akross mejor aria for Legos Stet. Sanwo-olu tok sey mek dem rimuv di imej of Fela Kuti wey Akinwunmi Ambode put for Allen Avenue for Ikeja to mek how muvment beta for dat aria. Dem go muv di imej to anoda aria for Legos Stet. Di Gofnor kommishon di Oshodi - Abule-Egba BRT Lane fo 2020.

Tins wey pipul dey ask chenj-am

For April 2020, for di time of COVID-19 pandemik, dem sey Sanwo-Olu no manej di COVID-19 moni well. PDP tok sey mek dem chek how di moni tek waka. For January 2022, di Pipuls Gazette riport sey Sanwo-Olu administrashion don inkris di monthly moni wey Legos dey pay to Alpha Beta LLC fom ₦800 million to ₦2.5 billion.Di desishun of di Govament to dey pay Alpha Beta big moni to handu tax mata don dey kos wahala tey tey bikos na di forma Legos Stet Gofnor Bola Tinubu dey kontrol Alpha Beta. Dem stil tok sey di moni inkris bikos of Tinubu nid moni to du im 2023 presidenshial kampan. Dem sey Sanwo-Olu agri to inkris di moni bikos E wan Tinubu soppot for e nest re-eleshion kampan.

Di kil-kil for Lekki chenj-am

For October 20, 2020, wen End SARS protest dey happun, di gofnor tok set mek pipul for Legos no waka any how for 24-hour fom 4 p.m., E kom leta shift am to 9 p.m. bot jost bifor 7 p.m., souja an polis don kom skata pipul wey dey protest. Dem shoot an kil pipul wey dey protest an injor meni pipul for lekki Toll gate. Bikos of di kil kil wey happun for lekki Toll Gate for End Sars protest enta Niuz an pipul wan no wetin rilli happun, Sanwo-Olu set up judishial panel to luk into di mata. Afta a year, for November 2021, di panel rilis ripot abaut di shootin. Di ripot fom di panel tok sey di shootin wey happun kill more dan nine pipul. Dis ripot difren from wetin Armi tok, sey nobodi dai. Bot, Sanwo-Olu kwik-kwik set up kommittee to rait white pepar for di panel riport an di white pepa kommittee deny sey any death happun.Dis white paper ripot wey deny di death kos kristism from civil society and protester.

Awod dem chenj-am

Babajide Olusola Sanwo-Olu don kolet plenti awods, som of di awod inklud:

  • Platinum awod fom di Legos Stet Poblik Savis klob.
  • 2009 Best for Human Capital Development awod fom di Industrial Training Fund (ITF).
  • Merit awod fom di Association of National Accountants of Nigeria.
  • Merit awod fom di Chartered Institute of Personnel Management in Nigeria (CIPMN).
  • Merit Awod fom di Association of Professional Women Engineers of Nigeria (APWEN).
  • LSDPC Impactful Leadership and Recognition Awod.
  • Media Nite-Out Awod for Best Govnor of di Year (2020).

Pasonal life chenj-am

Babajide Olusola Sanwo-Olu marri Dr. Ibijoke Sanwo-Olu.

Wie dem gada di tori chenj-am