Emmanuel Iwuanyanwu
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Emmanuel |
Wen dem bon am | 4 September 1942 |
Ples wey dem bon am | Imo State, Ikeduru |
Wen e kpai | 25 July 2024 |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Igbo langwej |
Wok wey e dey du | businessperson, politician |
Wie e go skul | University of Nigeria |
Party wey e dey for politis | Peoples Democratic Party |
E pipul | |
Awod wey e kolet | Academic honors and performance |
Emmanuel Chukwuemeka Iwuanyanwu (Dem bon am on 4 September 1942 an e kpai on 25 July 2024) na Naija politishan an biznesman. Some dey si am as one of Igbo pipo wey get moni pas for Naija.
How e tek stat life
chenj-amDem bon shif Emmanuel Iwuanyanwu on Friday September 4, 1942 to Pa Bernard Iwuanyanwu an Madam Hulder Iwuanyanwu of Umuohii Atta inside Ikeduru Lokal Govmet Aria of Imo Stet of Nigeria. Im granpapa, Iwuanyanwu, na kommanda wey kari lokal solja go fight. Dem bon am insaid famili wey no tu dey du shakara bikos dem get moni. Chief Iwuanyanwu na politishan, biznes man an pesin wey dey lik helep pipo wey no get plenti pipp sabi am as dat kind pesin tu. E go St Patrick's Skul, Nkpokwu (wey leta chenj to Rukpokwu), Port Harcourt, for im standard one rish four, fom 1948 rish 1952. For im standard five an six, dem transfa Emmanuel go Holy Trinity Chorch, Umuapara (wey leta bi Rumuapara, nau e dey Obiakpo Lokal Govmet Aria ,Rivers Stet). Dis one na from 1953 rish 1954. From 1955 to 1959, Iwuanyanwu go New Bethel College, Onitsha, Anambra Stet. In 1960, Emmanuel Iwuanyanwu, wit some oda pipo wey sabi buk wel go Federal School of Science wey de Legos Stet wia e tek stodi Pure an applied Mathematics, Fisis an Kemistri.
Edukeshon
chenj-amIn 1963, e get hopotuniti to go stodi for Yunivasiti of Nigeria, Nsukka wia e tek len Civil Engineering. Bikos of di kain way e tek sabi buks, dem giv Iwuanyanwu German Academik Exchange Scholarship wey bi sey na dem go pay for food,tiket wey e go yuz enta plane go dia, wey Fediral Repoblik of Germany sponsor.
Im pasonal life
chenj-amShif Iwuanyanwu wife na Eudora Nnenna Ozinyereaku. Di marej don pass ova 40 years an di marej produs five pikin-dem, three boi an five gel-pikin. E wife Eudora kpai on August 28, 2011, wen e dey 63 years. Shif Emmanuel Iwuanyanwu mari anoda wife wey bi Frances Chinonyerem (bifor di marej e papa nem na Enwerem) on September 14, 2013.
Wetin dem rait abaut am
chenj-amTwo volume of hau Emmanuel Iwuanyanwu laif wey Jeff Unaegbu, Sam Chukwu an Chinedu Nwafor rait abaut am in 2022. Dem giv am copi of di buk wen e dey du im 80th Birthday on September 4 2022.
Nashonal honors
chenj-am- Templet:Flag:
- Commander of the Order of the Federal Republic (CFR)
- Officer of the Order of the Federal Republic (OFR)
- Member of the Order of the Federal Republic (MFR)
Akademik Honors
chenj-amDoctor of Laws, Shaw University, Raleigh, North Carolina;
Doctor of Science, University of Jos, 1989;
Doctor of Science, University of Calabar, 1990.