Eedris Abdulkareem

Eedris Turayo Abdulkareem Ajenifuja (dey bon am 24 December 1974) wey pipo sabi wel wel as Eedris Abdulkareem na Naija hip hop singa an song raita. Na Abdulkareem bi di lid singa for di forma muzik band wey dia nem na The Remedies. Abdulkareem na one of di singa wey mek hip hop muzik popula for Naija. Pipo dey si am as one of most popula hip hop muzishan in Naija.

How e tek start life

chenj-am

Na for Kano Stet dey bon Abdulkareem. E papa mari more dan one wife. Abdulkareem papa kom from Ilesha wey dey Osun Stet an e mama from Ogun Stet. Osun Stet an Ogun Stet na Stet wey dey di Souta part of Naija. Wen Abdulkareem wan tek pipo di Stet wey e kom from, e dey always tok sey na from Kano Stet. Wen Abdulkareem bi two years, e papa kpai. Na Eight of Abdulkareem sinior brodas or sista don kpai.

How e tek start life

chenj-am

Na for Kano Stet dey bon Abdulkareem. E papa mari more dan one wife. Abdulkareem papa kom from Ilesha wey dey Osun Stet an e mama from Ogun Stet. Osun Stet an Ogun Stet na Stet wey dey di Souta part of Naija. Wen Abdulkareem wan tek pipo di Stet wey e kom from, e dey always tok sey na from Kano Stet.

Wen Abdulkareem bi two years, e papa kpai. Na Eight of Abdulkareem sinior brodas or sista don kpai.

E famili life

chenj-am

Abdulkareem wife nem na Yetunde an di marej don give dem pikin-dem Wen dey wan Kari Olympic torch waka pass Naija kontri, Abdulkareem de among di pipo wey kari di torch for hand waka pass for Naija. For June 2024, Eedris Abdulkareem rilis one song wey di taitu na "Emi Lokan". Inside di song, E tok wetin pain-am for di time wey Muhammadu Buhari stil bi presidor of Naija. E stil tok wetin pain-am for di Bola Tinubu govamet. Wetin pain-am bi sey, fud don ova cost an e tok sey one popula pastor Enoch Adeboye no gri tok for di mata. E tok sey Adeboye dey tok wen Goodluck Ebele Jonathan bi di presidor of Naija wey tins cost wel wel.