Yemi Blaq birth nem na Folayemi Olatunji im bi Naija fim akto, fim meka, songwrita, an model.

Hau im stat life an skul wey im go chenj-am

Na Ondo state, Naija den bon Yemi to Mr Olatunji .Yemi Blaq gro op for Lagos wie im attend and complete im primari skool, an Universiti edukashun. I go Adeyemi Demonstration Secondary skool for Ondo stet, an na im bi di fes Head boi. I stat to akt form im sekondari skul an kontinu till date.

Im wok chenj-am

Yemi Blaq stat to akt for Nollywood for 2005. I don regista wit di Aktors Guild of Nigeria té té so dat im go fit dey akt. Im fes fim wé mek Yemi popula na Lost of Lust wey im akt wit Mercy Johnson. Afta im fes movi, im com bikom akto wey meni produsa like, an im don akt plenti movi-dem.

Fim dem wey im akt chenj-am

  • The Good Samaritan 2 (2004)
  • Without Shame (2005)
  • Lost to Lust (2005)
  • 11 Days 11 Nights 2 (2005)
  • Traumatised (2006)
  • Total Control (2006)
  • Sting (2006)
  • Mamush (2006)
  • Desperate Ambition (2006)
  • Sinking Sands (2011)
  • Strive (2013)
  • President for a Day (2014)
  • The Last 3 Digits (2015)
  • Cultural Clash (2019)
  • 12 Noon (completed)
  • Shadow Parties (2020)