Wsiu Alabi Pasuma
Dey bon Wasiu Alabi Pasuma am foh 27th November 1967. Na Mushin Legos stet, e stey from wen he bi dey small till e grow. Na only him mama wey bi Alhaja Adijat Kubura Odetola wey pipul sabi as Iyawo Anobi as he tek dey praise her foh him musik sey na she bi him biggest sopot foh him musik Karia tek care of am.
He go to Muslim mission primary school foh 1973, bifor e kom muv to Nigerian Model High school wie e finish him sekondri skul.
Na since wen he don dey foh sekondri skul na him e don dey do e musik, wai oda student dem dey do tins wey konsan sport mata. Pasuma and som of e friend dem go sit dawn foh one kohna dey sing song on dia own
He stat to write e own song dem foh 1984. Dat time pesin wey e dey look as e role model na K1 De Ultimate bikos e still dey young, na dat sem 1984 e rilis his fest albom wey e nem am TALAZO 84. Meni of e fans dem praise am foh di albom, e kom giv am more pawa tu wan do more. Foh 1993, e kom rilis e fest official musik albom.
E Karia
chenj-amAs pipul stat to rekognaiz e albom wey e rilis for 1993, e don rilis albom dem wey don pass 30. Wey mek Pasuma to fit dey among one of di most Fuji musishian wey dey do well foh Nigeria. He don even join bodi sing song wit difrent difrent musishian dem like Bola Abimbola and King Sunny Ade. Apart from sey e dey sing, he don join bodi show foh difrent difrent Nigeria fim dem like [Iyanje] and [Alenibare].
Som of E Song Dem=
chenj-amFoh 2020, He rilis one song wey bi MMM (Money Making Machine). E rilis dis albom foh Covid-19 time, he kom tok sey e do di song to entaten e fans dem since dey don stop pipul to dey gada togeda to dey do big party bikos of di bad disease. Dat Musik wey bi MMM wey e do dat time kom bi one of e biges wok wey e do, e kom mek am dey popular well well again foh meni pipul wey don dey tok sey Fuji musik na one kind musik style wey don old.
Foh 2022, he rilis anoda musik style wey e kol am Afro fuji wey e join bodi togeda kom kolabo wit Qdot, di song nem na Omo Ologo. Afta dat one, e kom go rilis anoda two Fuji musik wey di title na: Legendary and December tonic. E kom kol dem Human nature.
Awod
chenj-amFoh 6 Sept 2015, Pasuma kom gain pipul atenshon well well, wey mek am win Olamide, Phyno, and Flavour as di Best Indigenous Artist of the year foh di Nigeria Entertainment Awards.
For 2021, E win di Best International Music Video Award wey Hollywood and African Prestigious Awards (HAPAwards) giv am.