Wikipedia:Mek wi gro Naijá Wikipedia
Mek wi gro Naijá Wikipedia
trenin/edit-a-thon to tek gro Naijá Wikipedia
30 August 2023 - 31 October 2023
Wetin dis event dey abaut?Dis projet na to gro Naijá Wikipedia so dat wi go get plenti atikul for difren difren katigori. Dis one go mek more pipul wey de spik Naijá to fit get koret infomeshon for Wikipedia. For nau, Naijá Wikipedia get smol atikul-dem for smol smol katigori and dis one dey afet am as beta ples wey pipul dey get fri infomashun. Di event go tren pipul wey go join hau dem go kontribut to di Nigerian pidgin Wikipedia. Wi go stil tren dem on hau den go translet atikul from English to Naijá and hau dem go tek find beta source to tek impruv di kwoliti of di atikul for Naijá Wikipedia Wen wi go du am?Wi go du am from 30 August 2023 – 31 October 2023 Wie wi go du am?Wi go gada togeda do am for fes-to-fes and wi go stil gada online. Di fes-to-fes na for di Lecture Theatre of the National Open University of Nigeria (NOUN), Lagos Study Centre. Di online na for Zoom, an wi go send di link giv pipul wey regista. Wetin go hapun for dia?
|