Victor Osimhen

Naija futbola
Victor Osimhen
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Fest nemVictor Chenj-am
Famili nemOsimhen Chenj-am
Wen dem bon am29 December 1998 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialityforward Chenj-am
Wen e stat wok2017 Chenj-am
Member of sports teamR. Charleroi S.C., Nigeria national football team, Lille OSC, VfL Wolfsburg, S.S.C. Napoli Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Sport number9 Chenj-am
Participant in2019 Africa Cup of Nations Chenj-am
LeagueSerie A Chenj-am

Victor James Osimhen (dem bon am for 29 December 1998) na Naija futbola wey pley as strika fo Seria A klob Napoli an di Naija nashional teem.

Dem bon am for Naijà, Osimhen stet im sinior Karier fo Germany at VfL Wolfsburg in 2007. Afta one season an half fo di klob, e kon go Belgian side Charleloi fo loan in 2018-19, bifor e kon go France at Lille. In 2020, Osimhen transfer to Seria A klob Napoli fo a klob rekod fee of £70 million. Na im win di Seria A Bes young playa awod in di 2021-22 season.

Na Osimhen win di Golden Boot awod at di 2015 FIFA U-17 Wod kop, wey Nigeria win. E first pley fo Naijà sinior teem in June 2017 an e pley fo di 2019 Afrika Kop of Nations.

Hau e tek stet lif chenj-am

Na Lagos dem bon Osimhen, im mama an papa na fom Edo stet. Wen e dey gro, Na Didier Drogba e lik to dey luk as e dey pley.

How e tek play for difren difren klob chenj-am

Osimhen stet im karier at di Ultimate Strikers Academy, wey dey Legos, Nigeria. In January 2016, Afta dey don ci sey e du Wel fo di 2015 FIFA U-17 Wod Kop, Osimhen kon du pre- kontrat wit VFL Wolfsburg, di kontrat na sey Osimhen go join di klob fo January 2017.

VFL Wolfsburg

On 5 January 2017, Osimhen sign a three-an-half year kontrat wit di klob, wey go end fo June 2020. Wen e rich di klob e no first pley bikos of wound wey e get, on 13 May 2013, Osimhen pley im first game fo Bundesliga an fo im klob Wolfsburg, e enta fo 59th minutes in a 1-1 draw wit Borrusia Monchenglabach.Osimhen pley fo im klub against Hamburger SV, wey bi di final match game day fo 2016-2017 season. E enta fo Sebastian Jung wey bi defender, di match end fo 1-1 draw, an Hamburg skore late wey mek dem Pas Wolfsburg fo di table, wey kon mek Wolfsburg go relegation pleyoff wit Eintracht Braunschweig. Osimhen dey fo di two matches. Wolfsburg win 2-0 fo di second leg, wey mek dem pley fo di next Bundesliga.

Osimhen nem dey fo 12 among 17 match dey playa wey fo di first half of 2017-18 season, E sho fo 5 games. E pley im first Bundesliga ful match on 28 January 2018 wit Hannover, wey dem win 1-0. Osimhen stet two more games, E pley ful match against Werder Bremen on 11 February an dey komot am fo first half fo Daniel Didavi against Hertha Berlin on 31 March. Wolfsburg kon dey fo pley off fo Religation. Osimhen no pley bikos of injury wey e get. Osimhen pley one game fo Wolfsburg's DFB Pokal campaign, E enta fo Josuha Guilavogui fo las ten minutes inside di match wey Schakle beat dem fo quarter-final. Osimhen du shoulder surgery on 2 May, wey mek am finish di season wit 12 match fo Bundesliga.

Charleroi

Osimhen du trial fo Belgian Klub Zulte Waregem an Club Brugge, wey bi di champions by dat time. E get malaria dat time wey affect dey way e luk, an di two club no gree sign am fo loan. On 22 August 2018, Osimhen join Belgian klub Charleroi fo loan, afta e no skore fo im klub Wolfsburg inside 16 match wey e pley fo dem. Dem yuz am reples Kaveh Rezaei, wey dem sel to Klub Brugge afta e skore 3 goals fo im first 3 games of di season. Osimhen first pley fo dem on September 1, wen im klub pley wit Excel Mouscron, e enta late fo Jèrèmy Perbet. Osimhen first pley im ful match on 22 September, E skore im first goal Wen dem pley wit Waasland-Beveren.

Osimhen stet match wit Adama Niane fo di nex four games, E skore di onli goal fo Napoli wen dey loose to Cercle Brugge an Gent. E skore two times fo di las five minutes in a 3-2 win ova Zulte Waregem on 21 October, afta Hamdi Harbaoui don giv Waregem 2-1 lead Wen e skore two times fo first half. Osimhen dey stet match fo im klub rich 25 November, wen e skore a goal wen dem kari am enta in di 4-2 win ova Lokeren. Afta di game, Osimhen tel BBC Sport sey e don ci happines again. Osimhen finish di first half wit 8 goals in 16 games, sekond onli to Cristian Benavente in di team.

Afta e don du wel wit di Belgian side, E pley 36 games an skore 20 goals, Charleroi anous sey dem wan buy Osimhen bikos e du wel fo dem Wen e dey fo loan.

Lille

In July 2019, Osimhen du kontrat wit Lille OSC. On 11 August 2019, e pley im first match fo dem, e skore two times fo inside 2-1 win against Nantes.

Na im bi di Lique 1 Playa of di Month fo September 2019, e skore two goals an du two assists inside five leaque matches fo Lille. On 2 June 2020, na Osimhen win Playa of di Season awod, afta plenti fans vote fo Osimhen.

Osimhen skore im first goal in UEFA Champions League on 2 October 2019, wen e enta inside di 1-2 match wey Chelsea beat dem fo home. E finish as top skorer fo Lille, wit 13 goals fo 25 Ligue1 matches, an 18 goals fom hol competition. Di way wey Osimhen dey pley an skore, mek meni pipul tok sey na im go bi di Afrika Playa of di Year fo future.

Napoli

On 31 July 2020, Seria A klob Napoli anous sey dey don sign Osimhen, fo klob rekod of £70 million wit add-on wey mek di moni dey lik £80 million, wey kon mek am dey insaid playa wey cos pas fo Afrika.

On 17 October 2020, Osimhen skore im first goal fo Napoli insaid 4-1 win wit Atalanta. Afta wey Osimhen skore e komot im shirt wey dem writ sey mek polis stop di killin of im pipul fo Naijà.

On 13 November 2020, fo Afrika kop of Nations qualifier game, dem kari Osimhen komot bikos e get injury. Dey go chek am an na shoder injury wey mek am no fit pley fo two months.

Wen e dey rekova fo di injury im klob giv am chans to dey fo im home contri Naija, wey mek am du im birthday fo Naijà. Na wen e dey Naijà dey du im birthday mek pipul bilif sey e tek gat COVID-19 virus, as e test positif wen e rich Naples. Di positif test an di shoder injury mek am no dey pley bol til 29 January 2021, wen dey kari am enta fo 20 minutes fo Napoli's Coppa Italia win wit Spezia.

International Karier chenj-am

Osimhen na memba of di Nigeria under-17 team wey win di 2015 FIFA U-17 Wod Kop fo Chile. E skore ten goals fo insaid seven games fo di tournament an win di Golden Booth an Silver Bol awods. As e tek pley mek am win di CAF Youth Playa of di Year 2015.

Osimhen first pley fo Naijà on 10 June 2017, insaid di match wey Nigeria beat South Africa 2-0. E no pley fo Nigeria's 2018 FIFA Wod kop bikos e no du Wel fo im klob Wolfsburg. Osimhen du Wel fo di klob wey dey loan am Charleroi, wey mek Gernot Rohr kol am fo November 2018 international break, wey dem stet wit a friendly win wit Uganda.

In Match 2019, dey rilis Osimhen fom di Supa Eagles to join di Naijà U23 side as dey don dey beat dem 2-0 to Libyan. E skore 3 goals fo di ritorn match wit Libyan fo Asaba.

Osimhen dey insaid Gernot Rohr's 28 man list fo 2019 Afrika kop of Nations in Egypt. Fo di third ples match, Osimhen enta fo Odion Ighalo wey get injury fo half time insaid di team 1-0 win wit Tunisia. E pley fo 45 minutes fo di tournament.

Di Supa Eagles end di 2021 AFCON qualifier Wel, dey beat Losotho 3-0. But, Osimhen miss di Afrika kop of Nations bikos im klob tok sey e get COVID-19.

Club chenj-am

Club Season League National cup League cup Continental Other Total
Division Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals
VfL Wolfsburg 2016–17 Bundesliga 2 0 0 0 Appearance in Bundesliga relegation play-offs 0 3 0
2017–18 12 0 1 0 13 0
Total 14 0 1 0 1 0 16 0
Charleroi (loan) 2018–19 Belgian Pro League 25 12 2 1 Appearances in Belgian Pro League European play-offs 7 36 20
Lille 2019–20 Ligue 1 27 13 3 1 3 2 5 Appearances in UEFA Champions League 2 38 18
S.S.C. Napoli|Napoli 2020–21 Serie A 24 10 3 0 3 Appearances in UEFA Europa League 0 0 0 30 10
2021–22 27 14 0 0 5 4 32 18
2022–23 5 2 0 0 0 6 2
Total 56 26 3 0 9 4 0 0 68 30
Career total 122 51 9 2 3 2 14 6 10 7 158 68

Internashional

Appearances and goals by national team and year
National team Year Apps Goals
Nigeria 2017 1 0
2018 1 0
2019 7 4
2020 1 1
2021 8 5
2022 4 5
Total 22 15

Honours chenj-am

Nigeria U17

  • FIFA U-17 World Cup]]: 2015 FIFA U-17 World Cup|2015

Naijà

  • Africa Cup of Nations third place: 2019 Africa Cup of Nations|2019

Individual

Wie dem gada di tori chenj-am