Umuhu na ward wey dey inside Ngor okpala Local government for imo state You fit find am along Aba/Owerri express For inside umuhu we get five villages and di nems na em be Egbelu, Umuechem, Umuota, Umueze and Amankwu/Mbutu For umuhu wey get one catholic church wey u go see for Mbutu okohia and di name na St Patrick Catholic church Umuhu people dem no dem with farming and dem dey go as far as buy other pipu farmland and dis one dey helep dem get plenty things from their farm wey be say dey go even carry go their major market wey di name na nkwo umuhu wey dey open once every week Growing up as pikin wey I be I remember sya umuhu get one king wey dey in charge of di five villages and him nem na Eze De Lord 1 wey kom from Egbelu umuhu, after wen him die for 2011 Everybody con dey wonder say who go be next king, but after some years dey con finally agree to sell di forms to pipu wey get interest to become di next and from wetin I no plenty pipu buy form but las las for 2016 December 27th na em dey con get new king and him name na Hrh Eze Basil Anyanwu from Umuechem Umuhu