Tahifod fifa or Tahifod na one disis wey one smol bateria wey bi Salmonella dey korse. Di sahin sey pesin get tahifod fit bi smol sahin or big sahin an e fit don dey sho six days or 30 days wey di salmonella bateria don enta bodi.For dat time, hi fifa go dey du pesin for meni days.Pesin go dey taya, bodi go dey pain pesin, pesin go dey go shit enihow, hed go dey pain pesin an pesin fit dey vomit.

How pesin tek dey kach Tahifod fifa chenj-am

Na human bein dey kari di disis pass go giv diasef.Dis one dey hapun wen di bateria wey dey inside di shit of one pesin rish di mouth of anoda pesin.Som pipul fit get am for bodi an dey no go no sey Dem get am bikos notin dey du dem bot if dey shit an e rish oda pipul mouth by fly wey rest ontop food, di pesin fit get tahifod.

How dokitor fit no sey you get Tahifod chenj-am

Na one test wey dem dey kol "Widal test" dikito fit yuz no if pésin get Tahifod fifa.Na pesin bulod, bone marrow or pesin shit mis wit dat Widal test (di test na to si how bodi dey fight salmonella if e dey bodi inside lab). For kontrie wey no get moni, wey dey no sey no bi malaria, disenteri or nemonia, na to giv di pesin one medisin kol kolofenikol an wait for di risot for di Widal test. Widal test na test wey serum of di bulod an salmonella bateria wey don kpai an som antigens.If di pesin serum get tahifod di test go sho dey smol smile tins like stone dey am.If di test dey klair e mins sey di pésin no get Tahifod bi dat. Rapid diagnostic tests Rapid diagnostic test like Tubex, Typhidot an Test-It too dey sho if pesin get tahifod.

Wetin pesin fit du not to kach tahifod fifa chenj-am

Pesin go nid to dey klin an di sorandin too go dey klin bikos tahifod like to waka for deti sorandin wey shit fit kom klose to fud an drink.Pesin go nid to arenj fud well by making suo sey dia hand klin.Pesin nid to put klorin inside drinking wota bikos klorin dey kil tahifod wey dey inside wota.