Tajudeen Abbas
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am19 October 1963 Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deymember of the House of Representatives of Nigeria, member of the House of Representatives of Nigeria, speaker Chenj-am

Tajudeen Abbas (dem bon am for 1 October 1963) na Naijà politishian an na im bi di niu 15 Spika of di haus of Representatives for Naijà sins 2023.

Hau e tek stat life an Skol chenj-am

Dem bon Abbas on October 1963 for Kwarbai, Zaria Stet, Nigeria. E get Bachelor's digre in biznes Administrashion an Master's fom Ahmadu Bello Univasiti, Zaria. E leta get doctorate digre in biznes Administrashion fom Usmanu Danfodiyo Univasiti Sokoto.

Hau e tek wok chenj-am

Abbas stat to dey wok as primari skol ticha. E leta kon wok as lecturer for one Polytechnic. Na lecturer for Kaduna stet Univasiti fom 1983 to 2001. E wok for compini sef as Marketing Manager for Nigerian Tobacco Distribution Company, wey don chenj to British American Tobacco Company. In 2010 e join politis an na e dey insaid pipu wey dey Haus of Representative in 2011. Abbas na king pikin fom Zazzau Emirates, Zaria, Kaduna Stet.

Hau e tek wok for politis chenj-am

Abbas join politis in 2010 an e enta as Haus of Representative in 2011. Na im stat lor wey plenti pas in di 8th Assemblies an e get rekod web e stat 74 bills insaid 21 wey dem sign insaid lor for 2019 an 2023. E wok for difren committee for di haus lik Commerce, Finance, Speshial Duties, Defence, Public Procurement, an Nashonal planning an Economic Development Committee. Bifor e enta for spika, na im bi di Haus Committee Chairman for Land transport. Abbas enta as spika of di 10th Assembli wit 353 votes fom 359 votes.

Wia dem gada di tori chenj-am

1. Vanguard. 13 June Retrieved .13 June 2023

2. Abbas-tajudeen-elected-speaker-with-353-votes. June 13 2023.retrieved June 13 2023