Titanik na wan inglish pipu big ship we skata for inside Atlantik oshon for April 14,1912 wen I go nak wan aisblok wey dey for di midu of di oshon wen I dey Joni from Southampton to New York. For inside abaot 2,224 pipu we dey inside di ship, pesin wey pas 1,500 na dem their,na dis wan mek am wey I bi sey di nomba of pipu we die na im don plenti pas for inside wan ship wey don skata. Dis tin wey hapun rili kash pipu ai sote dem du im foto an ivun du di fim mek pipu fo wosh. Taitanik na di ship we big pas fo ol di ship we dey ontop wota for dat time, an na im bi di sekond ship wey big pas for ol di big big ship wey dem do dat time. Na di kompini wey I nem na Harland an Wolff Shipyard we dey for Belfast mek Taitanik. Edward Smith wey bi di oga for di pipu wey dey drive di ship for dat dey sef die for wota. Di Taitanik ship Kari som of di pipu we rish for dat time an pipu de pak komot frm Great Britain, Ireland an plenti oda ples for Europe dey go United States to stat niu life their. Di Taitanik ship big sotey di ples wey rish pipu stey difrent frm where puo pipu dey stey. For di rish pipu side, fain fain tins dey like: suimin pu,laibri,daini tun an plenti oda enjoiment tins dey their. Titanik na wan ship sef wel wel for di wey we dey mek am, wota no go fit pas eni ples enta. As I big rish, I de Kari 48 smo smo bot for bodi wen I dey travu to sef pipu inkes katakata wan bos ontop wota. Bot for di dey wey I wan skata na jos 20 smol bot I Kari an na jos 1,178 pipu di 20 bot fit Kari join togeda we bi haf of di pipu (2,224) we Titanik Kari for dat dey wey pesin no fit foget.

Titanic Ireland

Ao I Tek Hapun chenj-am

Afta Titanik ship komot for Southampton for April 10 1912, I stop for Cherbourg we dey inside Frans. Afta, i stop egen for Queenstown inside Ireland bifo i bigin travu go New York, bot for Apri 14 1912, as I de travu dey go i jos nak wan aisblok wey dey inside di oshon arand 11:40 for nait. Wota bigin rosh enta shapshap. Na du smol smol pikin an wumen dem de fes stat to put fo di smo smo not dem bikos na wetin di law tok bi dat. Arand 2:20 for midnait, Titanik brek into tu wen pleti pipu stil dey inside am, an I sink bitwuin tu awas. Na jos 710 pipu dem fit sef for inside di kasala afta anoda big ship kom di pipu wey sovaiv.

Wia Wi Si Pruf chenj-am