Siminalaya Fubura
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Wen dem bon am | 28 January 1975 |
Ples wey dem bon am | Opobo |
Fest langwej | Ijaw |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej, Ijaw |
Wok wey e dey du | politician, accountant |
Post wey e dey | Governor of Rivers State |
Wie e go skul | Rivers State University of Science and Technology, University of Port Harcourt |
Party wey e dey for politis | Peoples Democratic Party |
E pipul | Ijaw people |
Rilijon | Christianity |
Hair kolor | black hair |
Amaopusenibo Siminalayi "Sim" Joseph Fubara ( dey bon 28 January 1975) na Naija pesin wey bi di govno of Riva Stet. Sim Fubura don fest work as Akauntant Jeneral of Riva Stet.
How e tek stat life an go skul
chenj-amNa for Opobo Town wey de Opodo/Nkoro Loka Govamet Aria of Riva Stet. E go Opodo Pamari Skul an e finish Komprehesive Sekondri Skul Opodo. Sim Fubura rid Akauntin at di Riva Stet Yunivasiti of Sayensi an Teknoloji. Na Yunivasiti of Pot Hakut e tek get e MBA satifiket in 2013. E kolet e Msc satifiket from di sem Yunivasiti in 2016.
Projet wey e sahin
chenj-amSim Fubura as di govno of Riva Stet sahin #195.3 billion naira kontat with Julius Berger mek dey yuz am do Pot Hakut Ring Road Projet. Wen dem go finish di road, di road go pass six Loka Govamet Aria of di Stet. Dis one go helep mek plenti pipo no tu de Pot Hakut siti an dis one fit mek di siti free smol. Di Govno tok sey di Stet go fest give Julius Berger 150 billion Naira mek dem tek start .
How e tek work
chenj-amSim Fubura start e karia in 2003 as akauntant with Riva Stet Sinior Sekondri Skul Board.
In 2015, e bikom di daretor of finans an akaunt at di Stet Govamet House. In March 2020, e bikom pamanet sekretiri of Riva Stet. Sim Fubura bikom di Akauntin Jeneral of Riva Stet on 23 December 2020 an e do e work go rish May 2022. E stop to bi di Akauntin Jeneral of Riva Stet bikos e don win di pamari eleshon wey PDP (People's Democratic Party|Pipo Demokrati Parti]] do for dia 2023 Jeneral Eleshon. Sim Fubura na memba of Nigeria Institute of Manijimet. E stil bi memba of Hassosiashon of Nashonal Akauntin of Nigeria.
Bad tins wey pipo tok sey e do
chenj-amFor May 2012, EFCC Ekonomik an Finanshial Krime Kommishon kol Sim Fubura an 58 odas govamet ofishal for how dey tek yuz 435 billion Naira.
Dem stil wan mek e wan tok wetin hapun to di 117 billion Naira wey im an four oda Riva Stet Govamet ofishal.
E pasonal life
chenj-amSim Fubura papa nem na Joseph Fubura an e mama nem na Love Fubura. E papa na forma souja wey go get trenin for Oyinbo land. Sim Fubura wife na Valerie Fubura an di marej produs three pikin.