Seyi Vibez
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
AliasVibez boy, Seyi Vibez Chenj-am
Wen dem bon am12 July 2000 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos State Chenj-am
Wok wey e dey dumusician Chenj-am
Wen e stat wok2019 Chenj-am
Record labelVibez Inc /dvpper Chenj-am

Balogun Afolabi Oluwaloseyi (dem bon am for 12 July 2000) wey pipul sabi wel wel as Seyi Vibez na Naija singa an song raita. Pipul sabi Seyi Vibez afta e rilis di muzik "Chance (Na Ham)" from di sekod muzik habom wey e nem "Billion Dollar Baby". Billion Dollar Baby habom rish nomba 19 on di UK Afrobit Singu an e rish nomba 7 on di Turn Table Top 100 chart

How e tek stat life chenj-am

Na for Ketu wey de Legos Stet dey bon Seyi Vibez on 12 July 2000. Seyi Vibez kom komot from Ketu go Ikorudu an na from Ikorodu e tek gro up. Do fest muzik singu wey e fest sing na "Anybody". Na di muzik "Godsent" mek pipo start to no am smol smol. For di sem year wey e rilis Godsent e rilis e fest habom kol "Nl Seyi No Vibez (NSNV). For 2022, Seyi Vibez rilis e sekod habom "Billion Dollar Baby" an e still rilis e Mixtape "Billion Dollar Baby 2.0". "Billion Dollar Baby habom rish nomba 1 on di Turntable 50 albums chart. MoreBranches put Seyi Vibez as one of di sistin (16) Afrika muzishian wey for do wel in 2022.

Seyi Vibez rilis e nomba 5 habom kol "Memory Card" an singa wey folo am sing for di habom bi: Amerika rappa YXNG K.A. Di fest week wey Seyi Vibez rilis di habom, na ova 6.3 million lisin to di habom from intanet an e dominet di "Turntable top 10 chart an Pan African Music nem di habom as one of ten best habom of January 2023.

Zlatan wok with Seyi Vibez to rilis Let There Be Light song on February 2, 2023. Di muzik rish nomba 14 on "Apple Music top 100 Nigeria chart". OkayAfrica nem "Alaska", one of di singu from Seyi Vibez as one of di best muzik to kom from Naija

As e mama kpai chenj-am

For March 16, Seyi Vibez mama kpai. Seyi Vibez no tok wetin kil am but e tok sey e mama death pain am no be smol.

E fight wit Zinoleesky chenj-am

Zinoleesky an Seyi Vibez no be frend at all. Di two singa dey tok enihow to demsef on soshal midia. Di fight start wen Zinoleesky advais Seyi Vibez sey mek e go bak to di way e dey sing bifor an some advais on how Seyi Vibez muzik fit beta wel wel.

Wetin Zinoleesky tok song no swit Seyi Vibez an e advais am mek e fest wok hard to get niu house bifor tokin to am.

Wie dem gada di tori chenj-am