Saheed Osupa
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am7 August 1969 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokYoruba Langwej, English langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusician Chenj-am
Wie e go skulAmerican International College Chenj-am
Wen e stat wok1983 Chenj-am

Akorede Babatunde Okunola (dem bon am for 7 August 1969) wey plenti pipul sabi for im wok as Saheed Osupa abi King Saheed Osupa (K.S.O), na Naija fuji singa, fim akto, an song raita.

How e tek stat life chenj-am

Dem born Saheed Osupa for insaid Mafoluku fo Ajegunle, Lagos State an na Ibadan, Oyo Stet e tek gro. Saheed papa wey e nem na Moshood Ajiwere Layeye dey du muzik sef an na Ayinde Barrister famili e bi.

Skul wey e go chenj-am

Amuwo Odofin High School wey dey Legos, na im e go. E kon go du im National Diploma for The Polytechnic,Ibadan. Saheed osupa kon stil go America International college.

Im wok chenj-am

Fuji Music

Saheed Osupa stat to dey sing fuji insaid 1983. Im fest album na Fuji Fa Disco, e kon du Fuji Blues. E don du pas 40 albums. Insaid 2018, Ayinde Barrister give Saheed Osupa "King of Fuji".

Hip Hop Music

Saheed Osupa du difren Hip hop music lik Non stop wey e rilis on 12 June 2008. Na 20 December 2014, e rilis "Vanakula". On 13 April 2015, e rilis Africa Beauty wey K-Solo produs. For 8 August 2015, e rilis "Womi" wey Seriki dey insaid.

Na 7 November 2015, Saheed Osupa nem dey insaid The Net as artist wey don dey du Wel Wel fo music.

Fims

Saheed Osupa don sho for yoruba pas 30 times insaid yoruba Fims.

Saheed Osupa an Alabi Pasuma quorell chenj-am

Saheed osupa an Alabi Pasuma get plenti quorell. Di one wey pipul sabi pas na di 1998/1999 own, an di quorell of 2007. One of di tins wey stat quorell na wen Saheed osupa an Kwam1 get quorell, Pasuma kon dey sopot Kwam1. Osupa rilis 10 rekods bikos of di quorell an all of dem sel Wel Wel, wey kon mek plenti pipul tok say na im win.

Som of im wok chenj-am

Singles

Wey e dey as lead Artist
Year Title Album
2014 "Vanakula" TBA
2015 "African Beauty"

"WOMI"

2018 "Lobadan" TBA
2018 Abeke TBA

Studio Albums

  • Fuji Fadisco
  • Fuji Blues
  • Fuji Demonstration
  • Master Blaster
  • Stainless Fuji
  • Fuji Boggie
  • Unbeatable
  • Shuffle Solo
  • Ovation
  • Scores
  • Hot Shot
  • Advice
  • New Edition(Shuffle Solo 11)
  • Authentic

Wie dem gada di tori chenj-am