Philip Shaibu
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Philip |
Famili nem | Shaibu |
Wen dem bon am | 1 December 1969 |
Ples wey dem bon am | Kaduna |
Fest langwej | Yekhee |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej, Yekhee |
Wok wey e dey du | politician |
Post wey e dey | member of the House of Representatives of Nigeria, Deputy Governor of Edo State |
Wie e go skul | Univasti of Jos, University of Benin |
Party wey e dey for politis | Peoples Democratic Party |
Rilijon | Christianity |
Hair kolor | black hair |
Philip Shaibu (dem bon am on 1 December 1969, for Kaduna) na forma Univasiti of Jos skul pesin, na Naija politishan. Na im bi di Deputy govnor of Edo State, Nigeria.
Im pasonal life an edukashon
chenj-amWen e smol
Dem bon Shaibu for Kaduna insaid Kristian famili. Im papa na Pasto Francis Osikpomobo Shaibu (e don kpai), an im mama na Lucy Momoh.
Hau e tek go skul
chenj-amDi fest skul wey e go wen e smol na St Augustine Primari Skul, Tundu Wada Kaduna, e kon finish for L.E.A Primari Skul Barnawa, Kaduna State wia e fest get skul certifikate, Shaibu get im West African Senior School Certificate in 1986 afta e go Saudana Memorial Sekondri Skul, Kawo Kaduna. Comrade Shaibu get Bachelor of Science digre (Honors) in Accounting fom di Universiti of Jos in 2000, wia e bi president of di National Association of Nigeria Student (NANS) for 2000 an 2001 an a masta of Biznes Administration (MBA) fom Universiti of Benin in 2015.
Im famili life
chenj-amE mari mrs. Maryann Phillip-Shaibu an dem don bon pinkin.
Im Pasonal life
chenj-amPhilip Shaibu fest stat to dey wok as e komot for skul wit Nigeria Prisons Service, Abuja. E leta komot wen e rish Assistant inspector of prisons post in 2002 to get taim du politis wel wel.
Politis wok
chenj-amPhilip Shaibu fes stat to dey du politis in 2003 Wen e wan go for Edo State Haus of Assembli onda All Nigeria people's Parti (ANPP) e no enta.
Shaibu trai enta in 2007 as pesin wey go stand for Estako West Consistency onda Action Congress (AC) for Edo stet Haus of Assembli, na im enta. For di Haus of Assembli na im bi di majority leader on 24 February 2010 afta dem komot Rt Hon. Zakawanun Garba as spika of Edo Stet Haus of Assembli.
In 2015, afta e don uze eight years for Edo Stet Haus of Assembli, e kon go trai go stand for Estako pipu for insaid fediral Haus of Representatives. Na im win wit 42,079 votes an pesin wey folo am na Abass Braimah wey get 29,941 votes.
Na onli im dey as pesin wey go bi Deputy govnor for govnor Goodwin Obaseki for di las eleshon wey dem du for 2016 Edo State gubernatorial eleshon an na dem enta.
On 16 June 2020, Shaibu komot for All Progressive Congress (APC).