Paul Biya wey dey fit stil kol Barthélemy Biya'a bi Mvondo (dey bon am 13 February 1933) na Kamerun politishan wey bi dia presidor. Biya na di sekond presidet wey Kamerun wan get for dia histri an e don bi presidet from 6 November 1982 till todey. From 1975 go rish 1982, Biya dey wok as Kamerun prime minista. If we gada di histri of pipo wey don bi presidet from Afrika kontinet, na Biya bi di nomba two pesin wey don tey as presidet for eni Afrika kontri. Biya bi di presidet wey old pass for di hol wold. Biya kom from di South aria of Kamerun. E start to dey mek disishon for politis mata wen Ahmadou Ahidjo bi Kamerun presidet. Dorin Ahmadou Ahidjo tim as presidor, Biya wok onda am as Seketri -Jenera to di presidet from 1968 go rish 1975 an leta wok as prime minista. Biya tek-ova as Kamerun presidet from Ahmadou Ahidjo wen Ahidjo ri-sain in 1982. Biya get komplet pawa as Kamerun presidet in 1983-1984 wen e kpai all di oda pipo-dem wey wan yuz wayo -wayo kolet pawa from am.