National Stadium Lagos

Di Lagos National stadium na Stadiom wey fit serve meni purpose and e dey surulere Legos Stet Naijá. Di stadiom get Olympic size swimmin pul an meni space wey dem fit yuz for athletics, rugby, basketball, volleyball, Table tennis, wrestling an boxing matches. E host meni intanashional kompetition laik di 1980 Afrika kup of Nations Final, di 2000 Afrika kup of Nations Final and FIFA Word kup qualifying matches. E bi di main stadiom for 1973 All Afrika Games.

Tori Abaut Di Stadiom chenj-am

Dem build di stadiom for 1972 and di stadiom get kapaciti wey bi 55,000 leta di kapaciti dem com reduce to 45,000 for 1999. Di rekord attendance na 85,000 an na for di final match of Afrika kup of Nashions for 1980 bitwin Naijá an Algeria dem get di record. For no rison di Nashional Stadiom don dey spoil bikos nobodi dey tekia of am again sice 2000s.Di last game wey dey du Insaid di stadiom na Nashional team games for 2004. Eni futbal match for Legos nowadaz dey happun for Teslim Balogun wit futbal matches wey dem move go nearby Teslim Balogun Stadiom. Na Religion tins an Aria Boys dey yuz di Stadiom now.People wey dey kontrol Sport ( National Sports Commission) gada to arenj di ples sice 2009.