Nancy Isime
Nancy Isime (dem bon am December 17, 1991) na Naijá aktres,model an midia pasonaliti.
Tori of e laif
chenj-amNa for Edo Stet dey tek bon Nancy Isime.E go University of Lagos go du one kouse for soshia wok for 2 years. Isime mama dai wen e dey 5 years old an na im papa tren am.Isime gro up for Legos an na Legos e tek du e pamari an junior Sekondiri edukashon.Isime kom go Benin go du e sinior sekondiri edukashon.E leta du six month bazik kouse for Uniiversity of Port Harcourt an Diploma for soshial wok for ' University of Lagos.
How e tek wok
chenj-amFor 2009, Nancy Isime win di miss valentine intanashonal beauti pageant an e kari sekod for di miss telikom Naijá beauti kontest.Isime du modelin for kompani dem laik "house of Marie" " Ade BaKere" "Adeboye Jones" "Zizi Cardow" Shakara Couture " "Konga Online" an odas. Isime tok somtin abaut di modelin for Naijá, e sey model na somtin wey pesin go tri plenti taim ontil pesin go get big break onlaik for westa kontri dem wey bi sey wen pesin get big break e don mek am for laif bi dat. Bot for Naijá, ivun wen pesin don get big break pesin stil nid to wok had to kip am so pesin nid to dey kom for mor.ns Nancy bi di tok tok for di voice of Naijá.
Aktin
chenj-amIsime stat ha karia as aktres for di TV series Echoes for 2011
Telivishon an Ivent Host
chenj-amIsime na telivishon prisenta, pipul no am for di amebo sho The squeeze Tekinologi sho What's Hot an backstage segment of MTN project fame season 7. For 2016, Isime ripias Toke makinwa as di prisenta of di popula sho wey pipul sabi luk for Hptv.Isime bi pat of di prisenta for di 2019 edishon of di Headies awad wit Reminisce.Na Isime bi di prisenta for The Voice Naijá for 2021.
Fims wet shi don du
chenj-am- Hex (2015)
- Tales of Eve (2015)
- On the Real (2016)
- A Trip to Jamaica (2016)
- Hire a Man (2017)
- Finding C.H.R.I.S (2017)
- The Surrogate (2017)
- Treachery (2017)
- Kanyamata
- Tempted
- Guilty
- Kylie's Quest
- A Better Family (2018)
- Club (2018)
- Johnny Just Come (2018)
- Liars and Pretenders (2018)
- My Name is Ivy (2018)
- Sideways (2018)
- Disguise (2018)
- Merry Men: The Real Yoruba Demons (2018)
- Don't get mad get even (2019)
- Hire a Woman (2019)
- Adaife (2019)
- The Millions (2019)
- Beauty in the Broken (2019)
- Another Angle (2019)
- Merry Men 2 (2019)
- Levi (2019)
- Living in Bondage: Breaking Free (2019)
- Made in Heaven (2019 film) (2019)
- Kambili: The Whole 30 Yards (2020)
- Creepy Lives Here (2021)
- The Razz Guy (2021)
Year | Awod | Katigori | Fim | Resot | ! Ref |
---|---|---|---|---|---|
2016 | city people Entertainment Awards | Best Vj of the year | N/A | win | |
2016 | Nigeria Broadcasters merits Awards | Sexiest on Air personality (Female) | HipTv | win | |
2017 | The future Awards | Best on Air personality (Visual) | N/A | win | |
2018 | Best of Nollywood Awards | Best Actress in a lead Role English | Disguise | Nominated | |
2018 | City people movie Awards | Most promising Actress (English) | N/A | win | |
2018 | City people movie Awards | Best supporting Actress (English) | N/A | win | |
2019 | Best of Nollywood Awards | Best kiss in a movie | Jofran | win | |
2019 | Best of Nollywood Awards | Best Actress in a lead role English | Jofran | Nominated | |
2021 | Net Honours | Most popular media personality (Female) | N/A | Nominated | |
2021 | Net Honours | Most searched media personality | N/A | Nominated |