Muhammadu Gambo Jimeta
Man abi wuman | man |
---|---|
Wen dem bon am | 15 April 1937 |
Ples wey dem bon am | Jimeta |
Wen e kpai | 21 January 2021 |
Fest langwej | Hausa langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Hausa langwej |
Muhammadu Gambo Jimeta (Dem bon am for 15 April 15, 1937 an e dai for January 21, 2021) na forma oga kpatakpata for di Naijá Police Force. Dem giv am di wok for 1986 afta Etim Inyang don komot an na Aliyu Attah kolet di wok afta e sef komot. Na e stil bi Nashonal Sekuriti Advaisa to Ibrahim Babangida Wey bi Naijá foma presido.
Tori of e laif
chenj-amDem bon am for Jimeta for April 15, 1937.
How e tek go skul
chenj-amGambo na nem wey dem dey kol am an na Jimeta Elementary skul(1947-49) an Yola Middle Skul(1950-55) e go wen e stil smol.
Afta, e go Bauchi Provincial Sekondri skul(1956 - 1958) an Govment koleg for (1958-1959) bifo e go Naijá Police koleg Kaduna an Police koleg Ikeja for (1959).
E stil go Detective Training School, Wakefield for Uk(1962), Bramhill Police koleg for Uk(1963), Intanashona Police Akademi, for Washington DC, USA(1980) an Nashona Police Akademi for Cairo, Egypt.
How e tek wok
chenj-amAfta e komot foy Police koleg, Gambo stat to wok as Cadet sub-Inspector. For 1963, dem promot am go Assistant Superintendent of Police(ASP). An for 1967 dem giv am Deputy Superintendent of Police(DSP). For 1969, dem giv am full Superintendent.
For 1972, dem promot am to Chief Superintendent of Police an for 1974 dem promote am to Assistant komishona of police. For 1977 dem promot am to komishona of police an na Lagos dem post am go. Dem giv am national fame as crack police offisa wey dey kach arm robas for di Stet.
For 1982, dem promot am to AIG an dem transfa am to Force Criminal Investigation Division for Alagbon Klose Lagos. For 1984, dem promot am go DIG an for 1986 dem promote am go Inspekto Genera of Police.
Afta e don ritaya
chenj-amFor 2011, Goodluck Jonathan wey bi di presido chuz am as memba of di Presidential Advisory Committee on Prerogative of Mercy.
How e tek dai
chenj-amE dai for Thursday January 21, 2021.