Mekuri (planet)
Part of | inner Solar System |
---|---|
Has use | colonization of Mercury |
IPA transcription | mɛʁˈkuːɐ̯ |
Named after | Mercury |
Demonym | Mercurien |
Location | inner Solar System |
Highest point | Caloris Montes |
Studied in | exploration of Mercury |
Discoverer or inventor | unknown value |
Time of discovery or invention | unknown value |
Site of astronomical discovery | unknown value |
Child astronomical body | Mercury's moon |
Parent astronomical body | Sun |
Geography of topic | surface of Mercury |
Has characteristic | Mercury's magnetic field |
Epoch | J2000.0 |
Stack Exchange tag | https://astronomy.stackexchange.com/tags/mercury |
Unicode character | ☿ |
Mercury bi di fes planet from Sun and di smallest for di Sola System. For Inglish and Naijá, e nem kom from di nem of di Roman god Mekurius (Mekuri), god of kommers and komunikaeshon, and di mesenja to di gods. Mekuri dey klasifaid as a terrestrial planet, wit rofli du saem surfais graviti as Mars. Di surfais of Mekuri dey kraetad hevili, as a risolt of kauntles impat events wey don akumulaet ova bilions of years. E lajes kraeta, Kaloris Planitia, get a daiameta of 1,550 km (960 mi) and wan-thord di daiameta of di planet (4,880 km or 3,030 mi). Simila to di Earth Moon, Mekuri surfais dey displei expansiv rups system wey jeneraet from thrust fults and braiht ray systems wey dey fomd bai impat event remnants.
Nem
chenj-amDi enshent pipo sabi Mekuri wit diferen diferen nem dependin on weda e bi evnin star or monin star. Bai abaut 350 BC, di enshent Greeks don aulredi rialaiz say di tuw stars na di saem. Dem sabi di planet as Στίλβων Stilbōn, wey mean "twinklin", and Ἑρμής Hermēs, for e fleetin moshon,Templet:LSJ, Templet:LSJ. a nem wey di moden Greek ritaen (Ερμής Ermis).[1] Di Romans nem di planet afta di Roman mesenja god wey get swift-foot, Mekuri (Latin Mekurius), wey Dem tek as equal wit di Greek Hemes, bekaus e dey muv akros for skai fasta than eni oda planet.[2][3] Di astronomikal symbol for Mekuri bi di stylaizd vashon of Hemes' caduceus; a Kristian kross kom dey added for di 16th centuri: .[4][5]
Also si
chenj-amReferens
chenj-am- ↑ "Diferen Greek Nem for di Planets". April 25, 2010. Retrieved February 23, 2024.
Emis bi di Greek nem of di planet Mekuri, wey bi di kloses planet to di Sun. E nem kom from di nem of di Greek God of kommers, Emis or Hemes, wey also bi di mesenja to di Enshent Greek gods.
Also si di Greek atikul abaut di planet. - ↑ Dunne, James A.; Burgess, Eric (1978). "Chapter Wan". Di Voyaij of Marina 10 – Mision to Venus and Mekuri. NASA Histri Ofis. Archived from the original on November 17, 2017. Retrieved July 12, 2017.
- ↑ Antoniadi, Eugène Michel (1974). Di Planet Mekuri. Translated from French by Moore, Patrick. Shaldon, Devon: Keith Reid Ltd. pp. 9–11. ISBN 978-0-904094-02-2.
- ↑ Duncan, John Charles (1946). Astronomi: A Textbook. Harper & Brothers. p. 125.
Di symbol for Mekuri dey represent di Caduceus, a wand wit tuw sapents wey dey twain araund am, wey di mesenja of di gods.dey kari.
- ↑
Jones, Alexander (1999). Astronomikal papiri from Oxyrhynchus. Amerikan Filosofikal Sosaiti. pp. 62–63. ISBN 9780871692337.
E dey posibul nau to tres di medival symbols for at least foh of di faiv planets to foms wey dey okur for som of di laetes papirus horoskops ([ P.Oxy. ] 4272, 4274, 4275 [...]). Mekuri bi a stylaizd caduceus.