Mariana Sadovska (dem bon am for 1972) na Ukraine aktres, singa, muzishan, an komposa. E de stey for Cologne.

How e tek wok chenj-am

Sadovska stat dey wok for Les Kurbas tiata (Lviv, Ukraine]] wey dey Anatole Vasiliev's Festival in Saint Petersburg an Moscow. Jerzy Grotowski wey dey Pontefera in Italy chuz am as one of membafor di "Slavic Pilgrim Project".Leta dat year, di pipul for Gardzienice tihata tok sey mek Sadovska dey wok for dem. E wok for di tihata as an aktor an muzik daretor for 10 years. Wen e de Gardzienice tihata, e stodies how difren difren kolsho dey sing an how e tek dey mek pipul wey dey lisin dey feel abaut di muzik. Sadovska Waka araund go stodi muzik wey kom from Ukraine, Ireland, Egypt, Cuba, an Brazil.E don organize how tradishonal singas of Ukraine go fit gain from muzishan wey kom Europe an United State. Sadovska yuz di moni wey "Earth Foundation" dey dash pipul travul go New York in 2001.For New York, E wok as muzik daretor for La Mama, wit "E.T.C." tihata kompini, "Yara Arts Group". Wen e stil dey New York, Sadovska stat to wok on how e go tek bi beta singa.E wok wit som muzishan like:Julian Kytasty, [Michael Alpert]] (wey dey Brave old World, Anthony Coleman, Frank London, Victoria Hanna an Sanda. In 2001, Global Village produs di fest Sadovska CD wey di tahitu bi:Song I learned in Ukraine In 2005, EVOE grup join Sadovska to produs e sekod CD "Borderland". Sadovska don sing inside som hevet sentral like Knitting Factory, Joe's Pub, BAM, Macor, [Galapagos]], an Exit Art. Sadovska bet studio wey e dey tek tish pipul abaut koret voice wey dey for yuz de sing.E sef len am for meni ples wey e don go like Grotowski Central for Poland, Intanashonal Workshop festival for Israel, Di Royal Shakespeare for London. Sadovska also len from meni akademik institushon like Harvard, Swarthmore, SUNY Buffalo, NYU, an UC Santa Barbara.

Famili chenj-am

Sadovska papa na Ukraine singa, Song raita an translator Viktor Morozov. Sadovska mari di German perfomans aktist Andre Erlen.

Song wey e don du chenj-am

  • Vesna (Flowfish Records 2015)
  • Vesna (Wizmar Records 2010)
  • Borderland (Wizmar Records 2005)
  • Gardzienice's Metamorfozy (Altmaster, Poland, 2000)
  • Songs I Learned in Ukraine (Global Village Music, US, June 2001)
  • Song Tree, 2001 in collaboration with Radio Lublin (Poland), Yara Arts Group (US) (UNESCO-produced)