Kevin Akpoguma(dem bon am fo 19 April 1995) na pesin wey dey pla ball fo bak fo 1899 Hoffenheim wey dey Bundesliga. Dem bon am fo Germany and im bin dey pla fo Germany wen im stil smal but e later kom dey pla fo Naija.

Im klob Caria chenj-am

Fo 2016-2017 im bin pla fo Fortuna Düsseldorf wey dey 2 Bundesliga. Fo 21 April 2017, wen di sisin don dey end im and Bernd Nehrig wey dey pla fo FC St. Pauli jam as dem dey pla togeda and im kom brake im nek.

Im fest show fo di next sisin fo 22 Oktoba 2017 an im komot Stefan Poch fo haf taim. Dem lata draw di mach wit 1899 Hoffenheim 1 - 1 Vfl Wolfsburg. Afta 4 dais, im stat mach wey dem lose Werder Bremen 1 - 0 1899 Hoffenheim.

Im intanashonal Caria chenj-am

Im mama na German wuman an im papa na Naija man. Bicus of dis wan im fit pla fo Germany or Naija. Im don pla fo Germany wen im neva old fo di U16, U17, U18, U19, U20 and U21 tim dem.

Na im bin captain fo di German U-20 tim an dem enta quatafinal fo di 2015 FIFA U-20 World cup wey dem do fo New Zealand.

Fo Oktoba 2018, im talk sa im fit pla fo Naija.

Fo 21 Septemba 2020, Naija coch Gernat Rohr tok sey Akpoguma don tok sey im go pla fo di Naija nashonal tim.

Fo 28 Septemba 2020, im tok am sey im go pla fo di Naija nashonal tim. Fo 9 Oktoba 2020 im pla fo Naija fo di fest taim fo wan frendli wey Algeria bit dem 1 - 0.