Kayode Egbetokun
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am1964 Chenj-am

Kayode Egbetokun (dem bon am on September 1964), na Naija polis ofisa wey bi di 22nd Inspecto General of Polis. Na President Bola Ahmed Tinubu apoint am afta e komot Usman Aikali Baba.

Hau e tek stat life an edukashon

chenj-am

Dem bon Egbetokun on 4 September 1964 in Erija wey dey Yewa Sauth Lokal Govmet Aria of Ogun Stet. E finish fom Universiti of Legos, Akoka, wit barchelor's digre in Mathematics in June 1987, kon leta kolet master's digre insaid Engineering Analysis in 1996. E du lectura smol for Yaba Teknika College of Teknologi.

E go du postgraduate diploma in Petroleum Ekonomics fom Delta Stet Universiti in 2004. E get PhD in Peace an Sekuriti Stodis fom Al-Hikmah Universiti wey dey Ilorin, Kwara Stet.

Egbetokun stat Nigeria Polis Fors on 3 March 1990 as a Cadet Assistant Supritendent of Polis in 1999, e dey wok as Chief Sekuriti Ofisa to di bifor bifor govnor of Legos Stet, Bola Tinubu, wey bi di president of Nigeria nau. E don sarf as Kommanda, Rapid Response Squad (RRS), Legos, Squadron Kommanda, MOPOL, Anti Fraud Unit, FCT kommand, Abuja, Chief Superintendent of Police, Administrashon, Legos Stet kommand headquarters, Ikeja, Aria Kommanda, Osogbo, Osun Stet Kommand an Aria Kommander, Gusau, Zamfara Stet Kommand.


On 19 June 2023, President Bola Ahmed Tinubu reples Usman Aikali Baba wit Egbetokun, bifor e bi inspector general of polis, na im bi di deputy genera of polis an na im wey dey monito DIG for di Sauth-West geo politika zone, wey head di Fors Criminal Investigations Department (FCID), Fors Headquarters, Abuja since 6 April 2023. [1]


Wia dem gada tori

chenj-am
  1. "Meet mathematician, ex-CSO to Tinubu appointed acting IGP, Kayode Egbetokun". Vanguard. 20 June 2023. Retrieved 20 June 2023.