Kate Scott
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | UK |
Orijina nem | Kate Giles |
Fest nem | Kate |
Famili nem | Abdo |
Wen dem bon am | 8 September 1981 |
Ples wey dem bon am | Manchester |
Pesin wey e mari | Ramtin Abdo, Malik Scott |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, German, French, Spanish |
Wok wey e dey du | journalist, sports journalist, television presenter, media consultant |
Wie e go skul | Withington Girls' School, Universidad de Málaga, University of Salford |
Official website | http://www.kateabdo.com/ |
Supported sports team | Manchester United F.C. |
Kate Scott (née Giles, formerly Abdo; dem bon am on 8 September 1981) na British sports broadcaster wey dey wok for CBS Sports. Plenti pipu sabi am bikos of di kain way shi dey kova associashon futbol, shi don annous for UEFA Champions League sins August 2020. Shi don wok for plenti kontri lik; United Kingdom, Spain, France, Germany, an di United State.[1]
How shi stat life
chenj-amDem bon am for Manchester, Na Christ the King Sku, Manchester, an Withington Girls' Skul, Scott tek stodi. Shi muv go Spain wen shi dey 17 years old, shi len Spanish, an du high Skul diploma for dia. Shi get digre for European langwej fom Universiti of Salford. Scott stil liv insaid France and Germany. Na shi dem selet to host CAF 2024 Awards for Morocco.
Na Gyanese pesin bikos im granmama sef na fom Gyanese.
Wok
chenj-amScott fest stat wok for German Intanashonal nius network Deutsche Welle in 2005, afta shi finish trainin insaid foreign language department. In 2006 - 07, shi wok as producshon assistant for Goal! The Bundesliga Magazine.
Fom dia, shi muv go CNN, wia shi dey wok for World Sport Programme daily. Scott leta komot for CNN go join Sky Sport
Wia dem ci pruf
chenj-am- ↑ CAF unveils presenter for 2024 awards. 16 December 2024, Punch Newspaper.