Kaffy
Kafayat Oluwatoyin Shafau (dem bon am for June 30, 1980) wey pipul sabi wel wel as Kaffy na Naija dansa, pesin wey de tich pipo how to dans an fitness koch. Na Kaffy bi di fonda an hona of Imagneto Dance Company. One tin wey dem tek no am wel bi sey shi na di Guinness World Record for di "Longest Dance Party" for di Nokia Silverbird Danceathon in 2006.
How shi Stat life an skul
chenj-amDem bon Kaffy an e gro up for Naija. Shi go Chrisland Skul Openings Opebi for im primari skul, an Coker Secondary School Orile-Iganmu, for im sekondiri Skul. Kaffy go Yaba College of Technology , shi rid Data Processing and Computer Science from Olabisi Onabanjo University. Kaffy for like bi Aeronautic Engineer
How e tek stat wok
chenj-amKaffy's dansin Karia stat wen shi go one event to pafom onstage for somebodi wey spot ha wen shi dey go Nashona Stediom for wik-ends for dans pratis an wokouts. For 2006, Kaffy lid im dans grop to break di Guinness Book of Record for "Longest Dance Party" after dey dans for 55 hour an 40 minute.Kaffy bi dans instructor wey divelop innovative visualisation-based methods to tich dans and dans fitness for accelerated-learning format. For 2017, shi form 'The Dance Workshop ' na dans convenshion wey di aim na to tren an mentor profeshona dansa an promote kolshora ex-chenj inside di Nigerian dance industry. Di 2017 Edition, America's lidin choreographer, AY Hollywood.
E Pasona life
chenj-amKaffy mari Joseph Ameh, wey bi music dareto and drumma for Naijá singa P-Square.Kaffy don bon two pikin.