Jamila Nagudu
Jamila Umar Nagudu (dem bon am for August 10, 1985) na Naijá Aktres wey dey akt for Hausa fim for Naijá.
How shi tek stat life an go skul
chenj-amDem bon Jamila Nagudu for August 10, 1985 for Magana Gumau, Toro loka govmet Aria wey dey Bauchi Stet, Naijá. Jamila go pramari an sekondri Skul for Bauchi Stet ↓
How shi tek wok
chenj-amJamila Umar wey pipu sabi as Jamila Umar Nagudu, do e fest Kannywood fim for year 2002. Sins e marej skata, Jamila don tok sey shi no dey marri again.Na wen shi komot for Bauchi go Kano na dia shi ondastand sey shi don popula inside Kannywood fim indostri. Pipul no am wel well for di indostri as a dansa sins (2002). Na dat dans mek daretos kom dey giv am rol for dia fim. Jamila fit do eni rol, shi don du lov fim bifor and shi don stil du fim wey dey mek pipul laf two.Jamila popula so tey pipul dey Kol am Queen of Kannywood. Na Aminu Saira bí di fest dareto wey fest giv Nagudu rol to akt inside di fim wey di nem na "Jamila da Jamilu".
Im pesona life
chenj-amJalima mari but di marej skata an shi bon one pikin wey bi boy.