Ijeoma Grace Agu na Naijá aktres wey dey among di nominashon for best supporting aktress in di 12th Africa movie Academy Awards. Ijeoma win most promising aktres in 2014 Best of Nollywood Awards. In 2007, shi mek e fest skreen apiarans for Eldorado TV series. Shi dey for dia kultura grop for 2012 London Olympic Games.

e pasona Life chenj-am

Agu na di fest pikin of di5 pikin dem wey e papa bon. Akordin to ripot for pulse Naijá, e gro up for Benin city an Lagos stet. Ijeoma get e fest digrí for Biochemistry fom Nnamdi Azikiwe University for 2007.E tok sey e papa hep am get konfidens to akt fins. Akordin to Ijeoma, e fest aktin karia stat for steg for Benin wen shi bi 14. Wen shi dey tok to The Nation niuspepa (Nigeria) abaut mek man dey slip wit man or mek wuman dey slip wit woman for Nollywood, Agu tok sey di akt na sin if we yuz riligion eye luk am bot sey e go akt am if e get rol to du am for fim.Shi folo tok sey shi no go sopot enitin wey go resot to wetin go mek pesin dia wen dey am abaut Biafra an as Nnamdi Kanu dey for prisen sel.

Fim wey e akt chenj-am

  • The Arrangement
  • Beyond Blood
  • One Room
  • The Choice of Aina
  • Flower Girl
  • From Within
  • Just Not Married
  • Kpians: The Feast of Souls (2014)
  • Taxi Driver
  • Hoodrush
  • Misfits
  • Love In A Time of Kekes
  • Women Are Scum
  • Package deal
  • Sylvia
  • Swallow