Goddowell Avwomakpa

Nigerian archbishop who was described by Isaiah Ogedegbe as "the man with burden for lost souls"
Goddowell Avwomakpa

Goddowell Avwomakpa (dem bon am for April 20, 1948), wey pipo sabi as Akbishop Dr. Goddowell Oyibo Ikoyi Avwomakpa,[1] na di Naija akbishop wey bi di fonda an di oga kpatakpata of di Christ Missionaries Krusaders Chorch,[2] wey dey for Warri, Delta Stet, Naija.

For August 22, 2022, Isaiah Ogedegbe bin prez Goddowell Avwomakpa an e kol am "di man wit burden for lost souls".[3] E bi bifor soja for di Naija Ami for 1967 dorin the Naija Sivu Wor,[3] but e leta konvet from militri to ministri and bikom a folowa of Cornelius Adam Igbudu.[2] [4]

How e tek stat life chenj-am

Na for Oginibo wey dey for di Ughelli Saut Loka Govamet Aria of Delta Stet dem bon Goddowell Avwomakpa for April 20, 1948, an e papa nem na Avwomakpa Majomi.[1][2] Tori don kari am sey dem buk e papa for operashon for Baptist Huspito Eku, an doktors tok sey afta di operashon mek e papa nor sleep wit wuman for three years.[1] Bifor di operashon, e papa bin promise God sey if e kom bak alive from di operashon and God also mek am fit bon pikin, e go give di pikin bak to God.[1]

Ministri chenj-am

Goddowell Avwomakpa dey run a Pentikosta Kristen ministri wit programs wey dey show for televishon.[5] E dey fokos on evanjelisim for vilej arias tru opun-air krusade an rivava servis. As e bin waka go meni komunitis, e dey prish sey mek pipul ripent and troway dia juju.[5] Goddowell Avwomakpa get di habit of saying, "Wen you mek God big, your wahala go bikom small".[6] Akording to Avwomakpa, e don bi prisha of di gospo an preya woriyo for di past fifty years.[7]

Pasona life chenj-am

Goddowell Avwomakpa mari two taims. E fes mari Deaconess Victoria O. Avwomakpa an dem bon nine pikins (six gels an three bois).[5] But shi kpai for June 12, 2020 wen shi bi 68 years.[8]


One year afta di dai of e fes waif, again e mari anoda wuman kol Sarah wey bin kom from Plateau Stet, for e chorch for Saturday, July 10, 2021.[9][10] Tori don also kari am sey som pastors, Urhobo kings an politikshians bin atend di wedin serimoni for e chorch.[9] E sekon waif full nem bifor marej na Sarah Emmanuel Dawel.[11]

Di fes son of Goddowell Avwomakpa, Kaycee Oghenenyerhovwo Avwomakpa dey mari a gospo singa kol Rhose Avwomakpa an dem bon three pikins (Jael, Joel an Jesse).[12]

Anoda son of Goddowell Avwomakpa na Mr. Tareri Avwomakpa an e bi lawya.[13]

Di DSS bin harest Mr. Tareri for Febuari 2017 ova di konsan wey e show for di katakata bitwin di DSS an Aposto Johnson Suleman an dem leta reliz am give e papa.[14] Tori don kari am sey di DSS again drag Goddowell Avwomakpa son, Mr. Tareri go court for 25 Febuari 2017.[15]

Kritisizim an kontrovasi chenj-am

For 12 Febuari 2017, som kritiks of Goddowell Avwomakpa bin kol am "a politikal akbishop" wen e bin selibrate di return from prison of di bifor bifor Delta Stet Govnor James Ibori wey chop imprisonmet bikos e tif di stet moni, an wen Avwomakpa bin prez Ibori as di light of di Urhobo neshon.[16][17]

Som of im kritiks leta akiuz am sey e bin kol James Ibori Jesus Christ, but Goddowell Avwomakpa don deny di aligeshon.[18]

For e chorch for July 2017, Goddowell Avwomakpa once again bin hold a speshal thanksgiving servis for James Ibori to honor im life.[19]

For April 10, 2018 an ahead of di 2019 jeneral eleshon, di Independent Niuspepa Naija bin ripot sey Goddowell Avwomakpa don tok sey mek di kristens wey dey for Naija go get dia PVC, an mek sure sey dem yuz am tek vote, bikos dat na di koret way dem fit vote out di yeye lidas wey dey wahala di kontri.[20]

For June 18, 2022, di Independent Niuspepa Naija also bin ripot sey Goddowell Avwomakpa don kondem di Owo katolik chorch killings an as e dey ves, e kom tok sey e si am as "one of di signs wey show sey di sekuriti system for di kontri don fail".[21] E don also kol on di bifor bifor Naija presido, Buhari to yuz di next months of im administreshon to re-organise di sekuriti system for di kontri so dat Naija pipul go fit enjoi peace an uniti.[21]

Buks chenj-am

Goddowell Avwomakpa don also poblish som Kristen buks wey e kol:

  • The World's Three Greatest Needs (2000)[5]
  • Pray That You Enter Not Into Temptation (2001)[5]
  • The Power For Breakthrough (2001)[5]

Posishons chenj-am

E bi di bifor Saut-Saut chairmo of di Kristen Asosiashon of Naija for Delta Stet an di lid pastor of di Christ Missionaries Krusaders Chorch.[10][22][23]

E bi also di bifor chairmo of di Pentikosta Feloship of Naija for Delta Stet.[5]

E bi also di bifor chairmo of di Naija Delta Bishops' Forum.[24]

Pej wey konsan dis one chenj-am

Wie dem gada di tori chenj-am

  1. 1.0 1.1 1.2 1.3 Ogedegbe, Isaiah (24 April 2023). "Platinum Celebration For Archbishop Dr. Goddowell Oyibo Ikoyi Avwomakpa". Opinion Nigeria. Archived from the original on 1 May 2023. Retrieved 13 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. 2.0 2.1 2.2 "Archbishop Goddowell Avwomakpa". NigerianWiki.com. Archived from the original on 2023-11-13. Retrieved 2023-11-13.
  3. 3.0 3.1 Ogedegbe, Isaiah (22 August 2022). "Archbishop Goddowell O. Avwomakpa: The man with burden for lost souls". Opinion Nigeria. Archived from the original on 29 August 2022. Retrieved 13 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  4. "'Military operation won't stop militancy in Niger Delta'". Vanguard News. 28 May 2016. Archived from the original on 11 August 2016. Retrieved 13 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  5. 5.0 5.1 5.2 5.3 5.4 5.5 5.6 "Our History". CMCC Warri. Archived from the original on 14 November 2023. Retrieved 14 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  6. Zahnd, Brian (2011). What To Do On The Worst Day Of Your Life. Charisma Media. p. 33. ISBN 978-159-979-754-0.
  7. "A word by Avwomakpa to Buhari". Vanguard News. 19 June 2016. Archived from the original on 25 August 2016. Retrieved 15 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  8. "Archbishop Avwomakpa's Wife For Burial On Saturday". Independent Newspaper Nigeria. 9 October 2020. Retrieved 15 November 2023.
  9. 9.0 9.1 Dafe, Daniel (10 July 2021). "Archbishop Goddowell Avwomakpa Remarries". Oasis Magazine. Archived from the original on 6 August 2021. Retrieved 15 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  10. 10.0 10.1 "Warri-based clergyman, Archbishop Goddowell Avwomakpa, remarries one year after demise of his wife (photos)". Linda Ikeji's Blog. 11 July 2021. Archived from the original on 11 July 2021. Retrieved 15 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  11. Michael, Okorohohi (12 July 2021). "Omo-Agege emphasizes Nigeria's Unity At Avwomakpa's Wedding". Independent Newspaper Nigeria. Retrieved 15 November 2023.
  12. Desalu, Horpeoluwar (25 May 2020). "Gospel Artist Rhose Avwomakpa Releases "You Are Good Live" Album". SelahAfrik.com. Archived from the original on 4 June 2020. Retrieved 15 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  13. Okpare, Ovie (14 June 2020). "Wife Of Former South-South CAN Chairman, Archbishop Avwomakpa, Dies At 68". Niger Delta Today. Archived from the original on 16 January 2021. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  14. "DSS releases pastor who mobilised support for Apostle Suleman". The Punch Newspaper. 3 February 2017. Archived from the original on 31 October 2022. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  15. Onyelemelam, Anurika (25 February 2017). "DSS drags lawyer to court for supporting Apostle Suleman". The Eagle Online. Archived from the original on 4 August 2023. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  16. "Ex-Convict Ibori Is Shinning Light Of Urhobo Nation Says, Archbishop". Sahara Reporters. 12 February 2017. Archived from the original on 6 July 2022. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  17. "Political Archbishop Awomakpa Pours Encomiums On Ex-Convict Former Delta Governor". Hard Reporters. 12 February 2017. Archived from the original on 16 November 2023. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  18. Omonigho, Matthew (10 March 2017). "I didn't say Ibori is Jesus Christ - Archbishop Avwomakpa". Daily Post Nigeria. Archived from the original on 17 August 2017. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  19. Eyoboka, Sam (30 July 2017). "Avwomakpa hosts Ibori to special service". Vanguard News. Archived from the original on 30 January 2020. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  20. Michael, Okorohohi (10 April 2018). "Get Your PVC To Vote Out Bad Leaders In 2019, Cleric Tells Christians". Independent Newspaper Nigeria. Archived from the original on 18 May 2022. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  21. 21.0 21.1 "Archbishop Avwomakpa Condemns Owo Killings, Tells Bubari To Re-Organise Security Apparatus". Independent Niuspepa Naija. 18 June 2022. Archived from the original on 18 June 2022. Retrieved 16 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  22. Aliyu, Moshood (3 February 2016). "Don't scrap maritime varsity, Avwomakpa appeals to govt". Guardian Newspapers. Archived from the original on 21 December 2016. Retrieved 15 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  23. Godwin, Ameh Comrade (15 November 2013). "CAN suspends Bishops for dabbling in politics". Daily Post Nigeria. Archived from the original on 14 July 2017. Retrieved 15 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  24. "Cleric Tasks Buhari on Governance". ThisDay Newspapers. 13 August 2016. Archived from the original on 23 February 2020. Retrieved 15 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)