Ghost story
Wikimedia disambiguation page

Ghost Story na eni tori or drama wey pipu wey don kpai wey kon wake dey insaid, abi eni tin wey dem du wey dem go du lik pesin wey don kpai wey leta sho. Di kpai pesin fit sho as di pesin kpai or dem fit sho am as magik. Di kpai pesin fit dey wori pesin wey get konecshon wit am, wia dem go kon uze pawa wey dem tai for a plez, or bodi wey pas pas am wetin dem dey uze wori dem to porshu am. Ghost tori na ezampu of ghostlore.

For simpu wey "Ghost Story" fit bi eni kain tori wey dey mek pipu fear. For pipu to tek get am fas fas, dem don du am for fim, an rait am for buk. Na tori ontop wetin pipu bliv an dey mek pipu fear, an na fim wey dey holways mek pipu fear.

Na to dey fear dem du lik du ghost tori , dem stil rait am to du som tins, lik to dey mek pipu laff an tich dem beta tins. Pipu wey don kpai wey sho dey holways let pipu sabi wetin fit hapun for fusure or wetin pipu wey dey ci tomorrow dey tok.

Histri chenj-am

Plenti pipu bliv sey na pipu wey don kpai na lik wota abi brees wey pesin no fit ci. Pipu wey dey du risarch don konet pesin wey don kpai to di reel pesin wen e neva kpai(sey na di pesin spirit), for old kolsho dem konet am to di pesin breath. Bliv for ghost plenti insaid kolsho wey dey for d world, an dem fit pas am for mauth to oda pipu abi mek dem rait am down.

Di Campfire tori, wey bi tori wey dem tok for mauth, wey dey abaut tori abaut pipu wey don kpai, or Tori wey dey mek pipu fear. Som of hol dis tori don tay, wey dey difren for meni kolsho. Meni skols an pipu wey sabi abaut buk dey holways tel pipu to dey rait am dawn for buk.

Insaid 1929, five tins wey dey impotant for English tori abaut pipu wey kpai dey for "Some Remarks on Ghost Stories" wey M.R. James du. As Frank Coffman tek gada evritin wey dey du buk na: .Hau dem tek uze lie lie du tru tru

. Hau sumtin wey dey fear pesin dey sweet

.No chans mek man dey slip wit wuman

.No tok abaut anoda pipu wey kon hep

.Settings

As dey tek bring pulp magazines insaide di stat of 1900s mek chans dey to dey rait abaut pipu wey kpai, dey kon stat dey sho for som oda buk lik Good Housekeeping an di New Yorker.

Buk chenj-am

Ezampu for stat

Pipu wey kpai dey sho as smoke or smol smol wota, na leta dem kon stil tok sey dem dey sho as dem kpai dem, sey pesin wey dem kil wit wund go sho wit im wund. Spirit for oipou wey don kpai dey for buk for stat lik Homer's an Odyssey, wey dey abaut waka to som oda world, an as for Bible for Old Testament wia di spirit of Endo kol di spirit of profet Samuel.