Emmanuel Iren
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Emmanuel |
Famili nem | Iren |
Wen dem bon am | 18 December 1989 |
Pesin wey e mari | Laju Iren |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
Wok wey e dey du | singa, pesin wey dey rait song, pastor |
Wie e go skul | Covenant University, University of Lagos |
Wen e stat wok | 2008 |
Instrument | drum, voice |
Emmanuel Aniefik Iren (dey bon am 18 December 1989) wey pipo sabi wel wel as Emmanuel Iren na Naija pasito, singa an song-raita. Na im bi di fonda of Selibreshon Chorch Intanashonal (CCI) wey dia head-kwuta dey Legos in Naija. Na Iren bi di presidor of Outburst Music Group, wey e form from im memba-dem wey dey kom e chorch. Iren don helep di musik grup produs fourteen song wey de two of di habom Kergma (2017), an Octave (2020). One of di musik wey Iren rait na Light Up The Way. Iren tell Eben wey bi anoda singa to folo am sing inside Light up the Way. Na for 2022, e rilis e fest habom Apostolos: Sounds of Transition
How e tek start life an go skul
chenj-amNa for 18 December 1989 dem bon Iren. Iren kom from Akwa Ibom Stet, in Naija. E go Saint Bernadette Nosiri an Pamari Skul wey de Ipaja, Legos. E kom go Queen's Choice Nosiri an Pamari Skul Kolej wey de Ikotun, Legos. Iren leta stil go Doregos Pravate Akedemi wia e finish e sekondiri skul. In 2011, Iren finish Covenant Yunivasiti wey de Ota, Naija. E rid Buidin Teknoloji. Iren do e masta digree in Yunivasiti of Legos wey e rid Buziness Administrashon.
How e tek work as Pastor
chenj-amIn 2008,Iren start one kristen kampus feloship wey e kol Triumphal Youth Fellowship wen e stil dey Kovenat Yunivasiti. Smol smol, di feloship dey grow ontil e rish chorch levu. Iren opun e fest chorch Triumphal Church in Legos on 11 November 2012. Two years leta, Iren chenj di nem of di chorch to Selibrashon Chorch Intanashonal (CCI). As tins dey now, di chorch don get ova 15,000 memba. Di chorch get ova 30 branshis hakros Naija, UK, Kanada an USA.
How e tek work as singa
chenj-amIren fest rilis di habom Kerygma in 2017. In 2021, one kristen muzishan Odunayo Adebayo ask Iren to join am sing one popula song wey di nem na Zoe. Iren rilis im sekond habom Apostolos: Voice of Transition. Dis habom get 13 song inside. Some of di song wey de inside na: Overcome, In your name, Holy Ghost, an Gory. For dis habom, Iren kol oda kristen muzishan to join am sing inside an some of dem na: Sinach, Nosa, an Judikay. Apostolos:Voice of Transition habom rish top ten on Apple Muzik.
How e tek akt film
chenj-amIren join as ezekutiv daretor in di film "What about us" wey dem rilis on 12 July 2024.
E pasonal life
chenj-amWen Iren de 24 years old, e mari Laju an dia marej don produs three girl an one boi
Awod-dem wey e don kolet
chenj-am- In 2021, YNaija magasin put Iren nem as one of di pipo wey popula pass in kristen ministri for Naija
- * In 2022, Iren habom Apostolos Voice of Transition de di katori of habom of di year. Na Kingdom Achiever Award do dis kompetishon
- * In 2023, Myles Lidaship Yunivasiti give Iren Honorari Doktorate