Dorcas Shola-Fapson
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | UK |
Fest nem | Dorcas, Shola |
Wen dem bon am | 4 January 1991 |
Ples wey dem bon am | London |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
Wok wey e dey du | actor |
Wie e go skul | University of Bedfordshire, University of Lagos |
Wen e stat wok | 2016 |
Dorcas Shola Fapson na pesin nem for Naijá we de akt fim an i stil de tok for difrent sho. Dem no am for di pat we im akt as 'Sophie' for Shuga wey MTV dey do. I go bak go kontinu di MTV shuga for 2020 bikos i konsain coronavirus mata an na difrent pipu for plenti kontri for Afrika join akt dis wan.
im Life
chenj-amDem bon Fapson for London for inside 1990s. Im mama kpai wen i dey 14 yez an im get im fest digri for England as pesin we len how pipu tek dey do kraim. I kom stil go len as pipu tek dey akt fim for New York.
I don akt plenti plenti pat as 'Sophie' for Shuga wey MTV dey do an i kom bi di pesin we dey tok for NdanTv sho wey dem dey kol "The Juice".
I folo akt for di pat 3 for MTV shuga an i go bak go kontinu as dokto as "Sophie" for di taim wey di tin kom bi smol-smol pat we dem dey kol MTV Shuga Alone Together we rili tok abaut di wahala wey coronavirus kos for 2020. Na Tunde Aladese rait am an na for difrent-difrent nait dem sho am an United Nations sopot am. Na for Naijá, South Africa, Kenya and Côte d'Ivoire dem akt di fim and di tori waka rish where dem kom dey tok for onli fone at am. Som of di pipu we akt di fim na Mohau Cele, Lerato Walaza, Sthandiwe Kgoroge, Uzoamaka Aniunoh, Mamarumo Marokane an Jemima Osunde.
Som fim we i don akt
chenj-am●Banana Island Ghost (2017)
●My Wife & I (2017)
●The Essence (2019)
Televishon
●Shuga (season 3): Shuga Naija (2013-2014, 2020)
●‘‘Castle & Castle ‘‘(2019-2021)
Yu stil fit chek
chenj-am●List of Yoruba people