Damilola Adegbite
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Damilola |
Famili nem | Adegbite |
Wen dem bon am | 18 May 1985 |
Ples wey dem bon am | Lagos |
Pesin wey e mari | Chris Attoh |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | actor, model |
Pat of wok wey e put mind | theater arts |
Wie e go skul | Bowen University, Queen's College, Lagos |
Academic degree | bachelor's degree |
Wie e dey liv | Lagos |
Wen e stat wok | 2008 |
Eye kolor | brown |
Personal pronoun | L484 |
Damilola Adegbite (dem bon Oluwadamilola Adegbite for 18 May 1985) na one Naija wuman wey dey akt muvi, model, an pesin wey dey sho wel wel for Telefishon. Na Damilola du Thelma Duke for insaid Tinsel, an kemi Williams insaid di muvi Flower Girl. Na Damilola win di award for bi di Best woman for insaid play wey dem dey sho for Telefishon for 2011 Naija Entatenment Award.
Shot histri of im Laif
chenj-amNa Surulere, for Lagos Stet dem bon am. Na Queen's kolej for Yaba shi go insaid Lagos an shi stodi Business Administration for Bowen Yunifasiti wey dey Iwo, for insaid Osun Stet. Na Tinsel bi di first muvi shi du. Shi sho wel wel for insaid advatisment an shi host some program ontop Telefishon. Im pasona Laif. Adegbite stat to dey love one man wey dey akt muvi,wey im nem na Chris Attah. Na wen dem dey akt one Telefishon play,wey dem kol Tinsel for August 2014,naim dem mit. Adegbite an Attoh du praivet marej for Accra,insaid Ghana for February 14,2015. Dem bon dia fest boy -pikin wey dem kol Brian for September 2014. Nius pipul tok sey Adegbite an im husband skata dia marej for September 2017.Na Adegbite fes dilit Chris Attoh nem from im social midia akaunt an dis sho sey dem no dey togeda again. Shi stop to dey folo Chris Attoh for Instagram, dilit Chris foto dem komot for im social media akaunt.Afta som hawa dem,wen dem dey intafiu am,Chris Attoh sef tok sey na tru sey dia marej don skata.