Christian Aggrey Apena

Nigerian Archbishop who was described by Isaiah Ogedegbe as "a very meek man of God with the sincere milk of the Word"
Christian Aggrey Apena

Christian Aggrey Apena (dem bon am for May 16, 1931 and e kpai for Oktoba 10, 2022),[1] wey dem also sabi as Christian Aggrey Ovwoma Apena, na di leit Naija relijos figor wey start di Bethesda Gospo Mishon.[2] Na im bi di fest ordained Pentikosta Bishop and Akbishop for Delta Stet, Naija.[3][4][5] [6] [7] [8] [9] [10] Apena papa na im bi di fest pastor for di Isoko rijon wey dem ordain for 31 Disemba 1931 and dem almost ordain Apena as Anglikan pastor bifor one relijos katakata mek am komot from di church.[1][3][4][8][9] Akording to Apena, "I komot from di Anglikan Church bikos I get di Pentikosta spirit wey dem nor get".[1] Wen e still dey di Church of Naija, Apena tok sey e bin get disagrimet wit di lait Evanjelis Cornelius Adam Igbudu wey bin akiuz am of "disturbing im ministri" for di Naija Anglikan Church. Afta e don komot from di Naija Anglikan Church, e bin work wit di lait Akbishop Benson Idahosa for di Church of God Mishon Intanashonal but e leta go im way to start im own ministri.[1]

Ministri chenj-am

Apena bin start im ministri for im vilej Irri wey dey for di Isoko Saut Lokal Gofmet Aria of Delta Stet, Naija. As persin wey dem dey kol "di papa of Pentikostalism" for Delta Stet,[10] dem sabi am evriwie for ordaining and mentoring meni Naija relijos figors for di stet.[1][3][5][6][7][8][9][11] Dem also sabi am evriwie as "a man wey bin spik truth to pawa" and Isaiah Ogedegbe don kol am "a veri hombo man of God wit di betalicious milk of di Word".[2]

Akording to Delta Stet bifor Gofnor Ifeanyi Okowa, Apena bin leave "di legasi of integriti and koret Bibol tishings".[12] Okowa also tok sey "e bi strong voice for di Kristen komuniti wie e bin tish di word of God witout fear or favour".[12] Akording to Isaiah Ogedegbe, "For a long taim, e bi a prisha of truth, an ezampo of agape luv, and jeniu humiliti. E dey sefles and komited to im koling".[2] Anorda persin also tok sey Apena bin "leave behind a legasi of humiliti, integriti, truthfulnes and steadfastnes to God".[8] Dem biliv sey e don fait "a gud fait of feit and komplit im earthli race and mishon".[11]

Dai and beriha chenj-am

Apena dai jejeli for di earli hours of Monday, 10 Oktoba 2022 wen e bi 91 years.[3][4][11][13] Tori nor kari am sey e dey sick bifor e kpai.[9][14]

Di beriha serimoni of di lait Akbishop Christian Aggrey Apena bin tek ples for im vilej Irri from 21 to 24 Disemba 2022.[13] Ogbonge Deltans wey bin attend di beriha na Ifeanyi Okowa, Emmanuel Uduaghan, Ayo Oritsejafor, Stella Omu and meni orda pipul.[9][14]

Pej wey konsan dis one chenj-am

Wie dem gada di tori chenj-am

  1. 1.0 1.1 1.2 1.3 1.4 Eyoboka, Sam; Abugoh, Gladys (1 December 2013). "Why I fought Idahosa, Anglicans - Archbishop Christian Aggrey Apena". Vanguard News. Archived from the original on 6 June 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. 2.0 2.1 2.2 Ogedegbe, Isaiah (12 October 2022). "Tribute To Archbishop Christian Aggrey Ovwoma Apena". Opinion Nigeria. Archived from the original on 29 October 2022. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  3. 3.0 3.1 3.2 3.3 Ekwu, Felix (10 October 2022). "First Pentecostal Bishop in Delta dies". NewsNet Nigeria. Archived from the original on 26 October 2022. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  4. 4.0 4.1 4.2 Ibrahim, Halima (10 October 2022). "Archbishop Apena Dies At 91". Archived from the original on 9 June 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  5. 5.0 5.1 "Archbishop Apena was a General in God's Army - Macaulay". Asaba Metro. 11 October 2022. Archived from the original on 6 February 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  6. 6.0 6.1 "Macaulay expresses grief over Archbishop Apena's demise". Advocate.ng. 11 October 2022. Archived from the original on 11 October 2022. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  7. 7.0 7.1 Abolo, Greg (12 October 2022). "Grief All Over Delta State, As Archbishop Apena Transits". The Oasis Reporters. Archived from the original on 9 June 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  8. 8.0 8.1 8.2 8.3 Oreh, Ajiri-Oghene (10 October 2022). "Ukodhiko mourns Archbishop Apena". Truth Reporters. Archived from the original on 9 June 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  9. 9.0 9.1 9.2 9.3 9.4 "Okowa, Uduaghan, others honour Archbishop Apena as a 'Great Gift to Humanity'". Political Economist NG. 23 December 2022. Archived from the original on 9 June 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  10. 10.0 10.1 Oreh, Ajiri-Oghene (12 October 2022). "IANA PG, Olomu mourns late spiritual leader, Archbishop Apena". Truth Reporters. Archived from the original on 9 June 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  11. 11.0 11.1 11.2 "Omote Laments Archbishop Apena's Demise". PoliticsGovernance.com. 10 October 2022. Archived from the original on 5 December 2022. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  12. 12.0 12.1 "Okowa Mourns Archbishop Apena". TheScript Nigeria. 12 October 2022. Archived from the original on 9 June 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  13. 13.0 13.1 "Odagwe leads provincial heads of CGMI in Isoko to condole family of late Arc Bishop Apena". NewsNet Nigeria. 21 December 2022. Archived from the original on 9 June 2023. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  14. 14.0 14.1 "Okowa Describes Late Archbishop Was A Great Gift To Humanity". Ndokwa Reporters. 24 December 2022. Archived from the original on 24 December 2022. Retrieved 11 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)